You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Peter Obi/Kwankwaso ticket 2027? Former Kano govnor join ADC
Di former presidential candidate of di New Nigeria People's Party (NNPP), Senator Rabiu Kwankwaso don formally port go di African Democratic Congress (ADC).
Di former minister of defence register wit di ADC and collect im membership card for Gidan Kwankwasiyya, Miller Road, Bompai, Kano.
Afta di registration e announce am for im X say "New Dawn. We be ADC."
Chieftains from di ADC and crowd of supporters wey mostly be Kwankwasiyya Movement witness di event.
Among di big-big pipo wey dey di na David Mark wey be former Senate President and ADC National Chairman, Rauf Aregbesola wey be di party National Secretary and former Minister of Interior and former Anambra govnor, Peter Obi.
Oda pipo include Sokoto State governor, Senator Aminu Tambuwal; former Minister of Transportation, Rotimi Amaechi; Senator Dino Melaye, former APC National Chairman, Chief John Odigie-Oyegun; and former Imo State Governor, Emeka Ihedioha.
Kwankwaso defect go ADC one day afta e officially announce say e don resign from di New Nigeria People's Party (NNPP) wey be di party wey e bin contest to be president for 2023 and come fourth.
Dis dey come afta Kwankwaso resign from di New Nigeria Peoples Party (NNPP), wey e be di founder and wey e use run for di office of di. president for di 2023. general elections.
For im resignation letter on Sunday, Kwankwao say e don find am necessary to identify wit anoda political platform wey go offer di best opportunity to effectively change di nation.
Remember say for January dis year, di former Kano State govnor bin don tell im Kwankwasiya movement say im dey tok wit some political parties wey wan make e joing dem, but im go only join party wey go give am guarantee of presidential or vice presidential ticket for di 2027 election.
E neva dey clear weda di ADC give Kwankwaso di guarantee, but dia tok-tok pesin Bolaji Abdullahi tell tori pipo say: "Di former Kano State Governor, Rabiu Musa Kwankwaso, dey join di ADC witout pre-condition. E dey come to contribute to building di party and supporting di work of di opposition. But ADC go provide level playing ground for evrione."
Kwankwaso bin visit former Vice President Atiku Abubakar for im house for Abuja, on Saturday, and tori be say dem also bin discuss about di decamping.
Impact of Kwankwaso movement to ADC
Political sabi pipo tok say dis move of Kwankwaso to di ADC na big boost for di opposition party.
Dr Kabiru Sufi tell BBC Hausa say Kwankwaso don prove imsef say e be heavyweight for Kano politics, especially wit im performance for di State during di 2023 election wia e get more dan one million votes and also win guvnorship seat for di NNPP.
As some strong politicians don already dey for di ADC, pipo like Peter Obi, Atiku Abubakar, Nasir El-Rufai and Rotimi Amaechi, oga Sufi say Kwankwanso joining di party go make dem stronger.
If dis movement work well, den 2023 go "be ogbonge real political contest betwin two major camps — di APC and di opposition bloc," Sufi tok.
Obi/Kwankwaso ticket?
Already, tok-tok don dey rise from di supporters of di former govnor of Anambra State Peter Obi, say e fit be im and Kwankwaso go fly di ADC flag for di 2027 general election.
Di tok start wen Peter Obi visit Kwankwaso for Kano during di Eid-El-Fitr celebration last week, wia e also address di hundreds of di members of di Kwankwasiya movement wey come to celebrate wit dia leader.
Dat warm reception wey Obi receive from Kano, na im be di first public indication say di two political heavyweights fit dey plan to work togeda.
Obi and Kwankwaso bin run president in 2023 as candidate of di Labour Party and di NNPP respectively, and togeda dem bin gada more dan 7.5 million votes.
If di two join for di same ticket for di coming election, some sabi pipo say dem fit give di ruling All Progressives Congress (APC) and di incumbent President Bola Tinubu a good fight.
Yunusa Tanko, wey be di tok-tok pesin for di Obidient Movement for Nigeria, agree say di idea of Obi and Kwankwaso joint ticket don dey gada support among Nigerians.
"Na me first start dis particular tok about Obi-Kwankwaso ticket. E be like say na im be di most acceptable idea if you do public poll, e dey obvious" Yunusa tell tori pipo.
"But na di pipo go still vote las las, and if dat na dia choice, why not?"
ADC heavyweights fit clash?
One big fear among supporters of di opposition joinbodi party na say as plenty heavyweights dey togeda for di same party, dem fit quarrel bicos nobody go wan gree for di oda.
Di ADC get plenty former State govnors as members including Rotimi Amaechi of Rivers State, Peter Obi of Anambra State, Nasir El-Rufai of Kaduna State, and Rauf Aregbesola of Osun State. Plus former Vice President Atiku Abubakar and former Senate President David Mark.
However, Yunusa Tanko say di politicians suppose realise say dem need to work togeda if dem go achieve any success.
"I fit tell you say wen di opportunity come to dem, dem go dey willing to work togeda...Na opportunity for evrione to come togeda as a team for di benefit of Nigeria, both as a political party and individuals wey get di capacity to comot dis particular govment wey don neva add value to human dignity for Nigeria," e tok.