IRGC Navy confam killing of dia commander Alireza Tangsiri and anoda pesin wey close di Strait of Hormuz

Read am in 5 mins

Di Revolutionary Guards don confam di death of Alireza Tangsiri "sake of severe injuries."

According to Iranian media, di commander of di IRGC navy die for one Israeli attack on one building for Bandar Abbas.

Three days ago, Israeli Defense Minister Israel Katz bin tok say Mr Tangsiri bin dey "directly responsible for di terrorist act of bombing and blocking di Strait of Hormuz" and dem bin kill am for di attack.

Di IRGC statement say di IRGC Navy commander na di target "while dem dey organise and strengthen forces and strengthen di defensive shield of islands and coasts."

According to di statement, "In di absence of dis brave commander, di IRGC naval forces dey currently present for di Strait of Hormuz, dem dey deliver decisive blows and dem dey manage am decisively too."

According to Mr Katz, some oda "senior Iranian naval command officials" also kpai for di attack.

Dis news dey come inside one tori of possible US operation to seize one of di Iranian islands.

For one decree wey dem bin issue for summer of 2018, Ayatollah Ali Khamenei, Iran former leader, bin appoint Alireza Tangsiri as commander of di IRGC Navy.

Bifor dat, im bin serve as deputy commander of di IRGC Navy for eight years, from 2010 to 2018.

Dem born Mr Tangsiri in 1962 for Tangestan, Bushehr Province.

Alireza Tangsiri na one of di architects of di plan to block di Strait of Hormuz, wey Iranian authorities don repeatedly use as a tool of threat ova di past 15 years.

Di commander of di Revolutionary Guards Navy bin recently respond to di first message from Mojtaba Khamenei, di new leader of di Islamic Republic, as e keep di Strait of Hormuz closed, saying, "We go deal di most severe blows to di enemy."

For 2012, im bin tok say as long as Iran dey use di Strait of Hormuz, to pass through dey free for odas.

Alireza Tangsiri, commander of di Revolutionary Guards Navy, na one of di well-known figures for di military structure of di slamic Republic of Iran, and im name bin dey tied to developments for di Persian Gulf, maritime security cases, and Iran display of military power.

Im bin command di ranian Navy for eight years during di most tense years for di Persian Gulf. D mission of controlling di security of di Strait of Hormuz and di Persian Gulf dey within di scope of responsibility of di IRGC Navy.

During im tenure, di IRGC Navy bin take aggressive approach, including seizing oil tankers and staging missile tests. Im bin also hold joint exercises wit Russia and China for di southern Iranian waters.

Dem sabi am well-well as pesin wey dey favor "high-handed" strategy of confronting di "enemy" outside regional waters, even though ultimately di kasala wit di United States don spread enta di region.

Dem sabi am for di IRGC forces as a strict and hard-working field commander wey dey present imsef for evriwia and for plenti exercises for di Persian Gulf.

Admiral Alireza Tangsiri bin also dey known as media figure sake of say e dey showcase di power wey di IRGC get including di unveiling of di IRGC naval missile complexes.

Tangsiri also dey known for im harsh statements. Im bin call, among oda tins, di three Iranian islands for di Persian Gulf "di honor of di great Islamic nation of Iran."

US bin put am for di sanctions list for 2019, during di first administration of Donald Trump .

Dat time, di US Treasury Department, in addition to Alireza Tangsiri, bin sanction Mohammad Pakpour, wey be di former-commander of di IRGC ground forces, and Amir Ali Hajizadeh, di former-commander of di IRGC aerospace forces.

Hajizadeh bin kpai on di first day of di12-day war for June last year, and oga Pakpour die on di first day of di Israeli-American attack on Iran in March.

For 2018, wen di kasala wit di first administration of Donald Trump begin serious, im tok say, "We get message for our Muslim neighbors, wey we don repeatedly state say we dey extend di hand of brotherhood to you, and wey beliv say di Persian Gulf na our home and we fit ensure di security of di Persian Gulf, no need for di presence of outsiders like di United States and kontris wey hia no be dia home."

For early February 2025, pipo bin raise tori about di assassination of Mr. Tangsiri but dem immediately deny am.

Di Jerusalem Post, cite one Israeli military source, wey bin write say "several aides" of Mr. Tangsiri also die for di attack.