You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Coronation of Chief Eziko as Igwe Ndigbo spark protest for South Africa Eastern Cape
Protests don break out all ova di Estern Cape of South Africa following di installation of one Nigerian King.
For videos wey don dey spread on top social media, e show say kasala don burst for di protest wey lead to di burning of private property.
Dis dey come less dan a week afta one man, Chief Solomon Ogbonna Eziko collect title as di Igwe Ndigbo Na East London.
Di coronation bin take social media by storm as one joinbodi of traditional leaders reveal say e dey against di customs to claim Kingship ova area wey alreadi get traditional leader.
According to di Chairman of di Eastern Cape House of Traditional and Khoisan Leaders (ECHTKL), Nkosi Mpumalanga Gwadiso, e tell loclal tori pipo, TimesLIVE say di area dey under di amaRharhabe kingdom wey dey di hand of King Sandile.
Di kontri public broadcaster, SABC, bin report say na di KuGompo city NGOs and di Eastern Cape residents bin gada for road to protest di mata and even at den di department of of Cooperative Governance and Traditional Affairs, COGTA and di Buffalo Municipality don comt to condemn di mata.
Prince Xhanti Sigcawu wey come from di Amathole House of Traditional Leaders call for di deportation of pipo wey get dia hand for inside di so-called coronation as e tok say, "I dey vex say Nigerians fit come hia and claim say dem get king for hia".
According to di Eastern Cape co-operative governance and traditional affairs MEC Zolile Williams, e say im department hand no dey inside di so-called installation of king by foreigners of di province.
All dis one dey come as di Nigerian Union for South Africa bin try clear di air on wetin di crowning of Nigerian King for East London actually mean.
Dem to say di move na just ceremonial title wey dey given to preserve du culture of Nigerians wey dey live for abroad and no go affect di local establishment of di host kontri, according to tori wey SABC bin report.
Di NUSA president Nwobi Smart bin dey reported say e tok say, "dis Cultural Ambassafor goo look to be di middle man between local authorities of di Nigerians wey dey stay for dis areas plus including di middle man for di embassies or consulate in case say sometin sup wia dem find say Nigerian nation don commit."
E come add say, "na dis cultural ambassador wey dem go call to chook mouth if attacks dey inside di locality."