You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
PDP national convention go hold despite all di kasala
One group of Nigeria opposition Peoples Democratic Party (PDP) dey hold dia own national convention.
Di party dey divided into two groups – one wey FCT Minister Nyesom Wike dey lead and di oda one wey Oyo State govnor Seyi Makinde dey control.
Na di Wike group dey dia convention for di Velodrome of the Moshood Abiola National Stadium oon Sunday despite say di oda faction do carry dia mata go Supreme Court.
According to di Constitution of di PDO (2017, as amended) – e say na a 19-member National Working Committee wey include di National Chairman, Deputy National Chairman, National Secretary and Deputy, Treasurer, Financial Secretary, Organising Secretary, Publicity Secretary, Auditor, Legal Adviser, Woman Leader, Youth Leader, and National Vice Chairman go oversee di party National convention.
As tins be, na caretaker committee of di group dey organise di convention.
Wetin Wike tok
Minister of di Federal Capital Territory, Nyesom Wike say dem go kontinu to reconcile di different factions of di party.
E tok dis one wen e dey inspect di venue of di Sunday event – "Chance dey for accommodation. Di PDP na very large party. Look di umbrella, e dey wide enof to accommodate evri one."
On di appeal by Kabiru Turaki before di Supreme Court, Wike say e no go affect di convention.
"We don already zone our positions. Evri zone get im own slot. We don zone di presidency to du South, while di chairmanship dey go North. We believe say dis consensus arrangement go make di process easier."
States divide weda to attend or not
E dey clear say PDP don really divide sake of wetin dey happun for many states.
While states like Edo, Kebbi and di rest say dem no go involve dia sef for di convention, odas including Rivers, Kwara, Osogbo and so on say dem stand gidigba wit Wike.
Already, Ini Ememobong wey be di National Publicity Secretary of di party wey di govnors dey support say dem no get hand for di convention.
"Our leaders, govnors, members of BoT, members of di National Executive Committee and others no go attend di convention," e tok.