Yemen Houthis join di Iran war wit attacks on Israel, as US Marines land di region

Read am in 5 mins

Di Houthi rebels of Yemen don launch missile strikes to Isreal on Saturday as dem tok say more attacks go follow for di coming days.

Yemen internationally recognised goment don call out wetin dem say na Iran frequent move to drag di kontri enta di kasala.

Dis dey come as major infrastructures for di Gulf kontris still dey under attacks as di Emirates Global Aluminium hala say dia major plant for Abu Dhabi don spoil well-well.

E also dey happun as di US say about 3,500 military personnel don land di region for di warshio USS Tripoli.

For early mor-mor on Saturday, di Israeli Defence Forces say dem identify one missile wey dem launch from Yemen, dis launch na wetin Reuters and AFP dey report say na di first from Yemen since di war start.

Even sef di Israeli army don confam di death of one of dia sojas of southern Lebanon even wia dem get men as dem reveal say dem don launch anoda wave of missiles enta Iran capital, Tehran on Saturday to target command centres and weapon sites.

Dis dey come afta one tok-tok pesin from di Iran backed Houthis say dem go chook mouth for inside di war if di Middle East kontinu dey run attacks for Iran.

For statement wey dem release for Telegram, Yahya Saree wey be di tok-tok pesin for di Yemeni Armed forces wey be di Houthi faction of Yemen military bin give three cases for dem to join di fight.

Dem be if amy oda kontri join di US and Israel against Iran, if US and Israel use di Red Sea bring kasala for Iran or any oda muslim kontri and finally, if dem continue wit escalation against Iran.

Di Houthis na armed political and religious group wey dey carry di Shia Muslim minority, di Zaidis for head.

Dem say dem dey part of di Iran led resistance agaist Israel, di US and di wider West togeda wit armed groups like Hamas or di Hezbollah movement for Lebanon.

Di group wey bin dey formed for di 1990s bin dey formally called Ansar Allah wey mean Partisans of God bifor dem come name demselves afta di pesin wey start di group, Hussein al-Houthi. E don don die so now na im broda, Abdul Malik al-Houthi dey run am.

But no be only Israel dey collect as oda Gulf kontris still dey face di effects of dis kasala ova di last 24 hours.

On Saturday, di United Arab Emirates bin get di highest number of ballistic missile attacks in weeks.

Emirates Global Aluminium say di attack for dia Abu Dhabi plant no only scata tins e also injure plenti of dia workers inside.

For Kuwait, di radar systen of dia international airport don spoil, no be small.

US men on ground for Middle east?

One Washington Post report bin announce say di Pentagon don prepare for weeks of ground operation for Iran.

But US officials bin dey quoted say dem tok say weda President Donald Trump go approve dis plan no dey clear.

Di plan no be full scale invasion but dem dey plan for raids by mixture of Special Operations forces and conventional infantry troops.

Dis one come afta US Secretary of State, Marco Rubio bin tell tori pipo say US fit achieve wetin dem dey find for di Middle East even witout boots for ground

Howeva, on Sauturday, di US Central Command tok say di USS Tripoli don land di region wit unit of like 3,500 sailors and marines togeda wit transport and strike fighter aircraft.

Meanwhile, Iran tori pipo wey include di official IRNA news agency don publish message from di Iranian Parliament Speaker Mohammad Bagher Ghalibaf wey mark 30 days since di war start.

For di message e tok say, Iranian forces dey "wait forAmerican sojas to enta di ground so dem fit rain fire on top dem."

Earlier dis month President Trump bin tell trori pipo about di possibilty of troops for ground say, "I no dey put troops for anywia. If I dey do am, I definitely no go tell you".