Peter Obi/Kwankwaso ticket 2027? Speculations rise as former Kano govnor set to join ADC

Di tok of Peter Obi and Kwankwaso join bodi start afta di two former govnors bin celebrate Sallah togeda for Kano last week

Wia dis foto come from, Rabiu Musa Kwankwaso/Facebook

Read am in 5 mins

Former Kano State govnor, Rabiu Musa Kwankwaso don set to officially join di opposition joinbodi political party for Nigeria wey be di African Democratic Congress (ADC).

Dis na according to wetin one of im loyalists Yusuf Ibrahim Kofar-Mata tell BBC Hausa dis Monday morning Kofar-Mata na di immediate past Commissioner for Science and Technology for Kano State, wey resign afta di govnor Abba Yusuf join di APC.

Also, di tok-tok pesin for di ADC, Bolaji Abdullahi confam to tori pipo say na true say Kwankwaso go join di opposition joinbodi party.

Kwankwso also publish one post for im social media handles showing emoji of red colour and handshake. Red na di colour of di Kwankwasiya movement and handshake na di logo of di ADC.

Dis dey come afta Kwankwaso resign from di New Nigeria Peoples Party (NNPP), wey e be di founder and wey e use run for di office of di. president for di 2023. general elections.

For im resignation letter on Sunday, Kwankwao say e don find am necessary to identify wit anoda political platform wey go offer di best opportunity to effectively change di nation.

Remember say for January dis year, di former Kano State govnor bin don tell im Kwankwasiya movement say im dey tok wit some political parties wey wan make e joing dem, but im go only join party wey go give am guarantee of presidential or vice presidential ticket for di 2027 election.

E neva dey clear weda di ADC give Kwankwaso di guarantee, but dia tok-tok pesin Bolaji Abdullahi tell tori pipo say: "Di former Kano State Governor, Rabiu Musa Kwankwaso, dey join di ADC witout pre-condition. E dey come to contribute to building di party and supporting di work of di opposition. But ADC go provide level playing ground for evrione."

Kwankwaso bin visit former Vice President Atiku Abubakar for im house for Abuja, on Saturday, and tori be say dem also bin discuss about di decamping.

Impact of Kwankwaso movement to ADC

ADC handshake logo

Wia dis foto come from, Rabiu Musa Kwankwaso/Facebook

Wetin we call dis foto, Kwankwaso publish di foto for di left for im social media handles on Monday...Red na di colour of di Kwankwasiya movement and handshake na di logo of di ADC

Political sabi pipo tok say dis move of Kwankwaso to di ADC na big boost for di opposition party.

Dr Kabiru Sufi tell BBC Hausa say Kwankwaso don prove imsef say e be heavyweight for Kano politics, especially wit im performance for di State during di 2023 election wia e get more dan one million votes and also win guvnorship seat for di NNPP.

As some strong politicians don already dey for di ADC, pipo like Peter Obi, Atiku Abubakar, Nasir El-Rufai and Rotimi Amaechi, oga Sufi say Kwankwanso joining di party go make dem stronger.

If dis movement work well, den 2023 go "be ogbonge real political contest betwin two major camps — di APC and di opposition bloc," Sufi tok.

Obi/Kwankwaso ticket?

Rabiu Musa Kwankwaso

Wia dis foto come from, Rabiu Musa Kwankwaso

Already, tok-tok don dey rise from di supporters of di former govnor of Anambra State Peter Obi, say e fit be im and Kwankwaso go fly di ADC flag for di 2027 general election.

Di tok start wen Peter Obi visit Kwankwaso for Kano during di Eid-El-Fitr celebration last week, wia e also address di hundreds of di members of di Kwankwasiya movement wey come to celebrate wit dia leader.

Dat warm reception wey Obi receive from Kano, na im be di first public indication say di two political heavyweights fit dey plan to work togeda.

Obi and Kwankwaso bin run president in 2023 as candidate of di Labour Party and di NNPP respectively, and togeda dem bin gada more dan 7.5 million votes.

If di two join for di same ticket for di coming election, some sabi pipo say dem fit give di ruling All Progressives Congress (APC) and di incumbent President Bola Tinubu a good fight.

Yunusa Tanko, wey be di tok-tok pesin for di Obidient Movement for Nigeria, agree say di idea of Obi and Kwankwaso joint ticket don dey gada support among Nigerians.

"Na me first start dis particular tok about Obi-Kwankwaso ticket. E be like say na im be di most acceptable idea if you do public poll, e dey obvious" Yunusa tell tori pipo.

"But na di pipo go still vote las las, and if dat na dia choice, why not?"

ADC heavyweights fit clash?

One big fear among supporters of di opposition joinbodi party na say as plenty heavyweights dey togeda for di same party, dem fit quarrel bicos nobody go wan gree for di oda.

Di ADC get plenty former State govnors as members including Rotimi Amaechi of Rivers State, Peter Obi of Anambra State, Nasir El-Rufai of Kaduna State, and Rauf Aregbesola of Osun State. Plus former Vice President Atiku Abubakar and former Senate President David Mark.

However, Yunusa Tanko say di politicians suppose realise say dem need to work togeda if dem go achieve any success.

"I fit tell you say wen di opportunity come to dem, dem go dey willing to work togeda...Na opportunity for evrione to come togeda as a team for di benefit of Nigeria, both as a political party and individuals wey get di capacity to comot dis particular govment wey don neva add value to human dignity for Nigeria," e tok.