Man kill seven of im own children and anoda one wey no be im pikin for Louisiana mass shooting
- Author, Grace Eliza Goodwin
- Author, Toby Mann
- Role, BBC News
- Read am in 4 mins
One papa don kill seven of im own children and anoda pikin wey no relate to am for mass shooting in Shreveport for di US state of Louisiana wey police don call "domestic disturbance".
Di children na between ages one year old to 14 years old, di BBC US new partner CBS report.
Officers say di shooting start about 05:00 (10:00 GMT) on Sunday.
Di suspect shoot 10 pipo before e run wit car wey e tiff, Shreveport Police Department tok-tok pesin Chris Bordelon tok. Police den chase and kill am.
Two adult women, including di mother of di children, dey for critical condition.

Wia dis foto come from, Reuters
Dem don identify di suspect as Shamar Elkins, Shreveport mayor communications director Leigh Anne Evensky tell di BBC.
Di suspect bin shoot one woman on di street before e enta one nearby residence wia e kill di eight children, "one of dem no even relate to am", according to police.
One of di victims run enta one house wey near and call authorities, police tok.
Dem say di gunman act alone. A ninth child jump from di roof and dey for hospital, Bordelon tok.
Shreveport Mayor Tom Arceneaux on Sunday tok say: "Dis na tragic situation - maybe di worst tragic situation wey don ever happun for Shreveport.
"We get hurting families, we have hurting police officers, coroner personnel.
"Dis affect di entire community, so we all dey mourn wit diz families."
Di incident na di deadliest mass shooting in di US since January 2024, wen eight victims die for Joliet, Illinois, according to di Gun Violence Archive (GVA), one nonprofit wey dey track US gun violence.
GVA define mass shooting as an incident wia four or more be victims of shooting, wey no include di suspect.
Bordelon say officers enta one house just before 06:00 local time and see di children.
"All of di pipo wey die for dis case na juveniles," Bordelon add.
E say officers determine say di call dey "domestic in nature".
Afta di shooting di suspected gunman tiff car and attempt to run, police tok.
Police say officers chase am inside anoda neighbourhood, Bossier Parish, and fire di suspected gunman, wey don die now.

Shreveport Police Chief Wayne Smith say im heart go out to di entire community.
"I just no fit start to imagine how such event fit occur," Smith tok.
E add say di investigation dey happun in coordination wit di Louisiana State Police and wit assistance from oda agencies.
"We go dey work diligently however long e take to get some ansas to wetin don happun," e tok.
Shreveport councilman Grayson Boucher say more dan 30% of crimes and 30% of murders in di city "relate to domestic mata", adding say: "Now di number don go up."
"We don more dan double our homicide in di city of Shreveport becos of one act of domestic violence," e tok.
Louisiana Governor Jeff Landry say im and im and wife dey "heartbroken over dis horrific situation, and we dey pray for evri body wey dey affected".
"We dey deeply grateful to di law enforcement officers and first responders wey dey work tirelessly on di scene," Landry add.
House Speaker Mike Johnson, wey dey represents Louisiana Fourth District, don also tok about di "heartbreaking tragedy".
"We dey hold di victims, dia families and loved ones, and our Shreveport community close in our thoughts and prayers during dis incredibly difficult time," e tok, adding say e dey grateful for di quick response of local police.

Wia dis foto come from, Reuters










