Tinubu address light matter, oda tins wey happun for APC convention

President Bola Tinubu and im Vice President Kashim Shettima stand togeda

Wia dis foto come from, APC

Read am in 6 mins

Afta hours of ogbonge deliberations, di All Progressives Congress (APC) don finish dia National Convention wey bing back Nentawe Yilwatda as national charman.

Di ruling party also retain Surajudeen Basiru as dia secretary and oda members of di National Working Committee (NWC) of di party bin dey elected wit concensus arrangement wey delegates bin ratify for di convension.

Di Convention Election Committee announce di members of di NWC for di 4th Elective National Convention of di APC.

Odas wey bin dey picked na Felix Morka as di publicity secretary and Dayo Israel wey keep im role as youth leader.

Dis convention bin hold wit ova 8,000 delegates who Tinubu tell say di kontri dey on di right track even though di road dey rough.

APC leaders mount for stage

Di Nigerian president add say even wit di way light no dey dey so, beta days dey come especially wit policies like di Grid Asset Management Company.

E also tok about how investments into di kontri don dey increase.

Oda pipo wey tok for dis convention include Yilwatda for im acceptance speech, di chairman of id Progressives Govnors Forum (PGF) Hope Uzodinma, di Minister of Finance, Wale Edun and di All Progressives Congress (APC) National Convention Planning Committee, Bello Masari wey tok say APC be di number one party.

From winning 20 States govnorship seats afta di 2023 general and off-cycle elections, di APC now get 31 govnors out of di 36 States for Nigeria as many govnors dump dia platforms to join di party wey dey power.

Also di party now control more dan two-thirds of di members of di Nigeria Senate with 85 out of 109 senators. Same tin for di House of Representatives wia dem get get 242 out of di 360 members.

PDP plan fresh national convention March 29-30

PDP national convetion in Ibadan, Oyo State, 2025 wey di Court of Appeal later nullify

Wia dis foto come from, PDP

Wetin we call dis foto, Di court of appeal bin nullify di 2025 national convention wey di PDP bin hold for Ibadan Oyo State wia Tanimu Turaki bin dey elected National Chairman

Di PDP still dey try to recover from di recent judgement by di Court of Appeal wey nullify di national congress wey a faction of di party bin hold last year for Ibadan, Oyo State.

Afta dis judgement, di PDP bicom weaker as on of dia govnors, Dauda Lawal of Zamfara State, comot from di party go join APC.

Now, di PDP faction led by Tanimu Turaki who di appeal court bin nullify im election as national chairman, don approach di faction wey dey headed by di Minister of di Federal Capital Territory, Nyesom Wike, for dem to make peace.

Dis dey come as di Wike faction bin don set new date for dia national congress to be on March 29 and 30, just one day afta di APC own.

Turaki tell tori pipo on Tuesday say: "I fit confam say, as of today, leaders for both sides don break di ice and we dey explore various pathways towards a lasting resolution."

"We get confidence say we fit still work togeda and dis reconciliation go work. In life, e get times to fight, and e also get time to make peace."

Turaki assure PDP members wey neva jump comot from di party say make dem no fear as dem go do evritin possible to make sure say di party go bring out candidates for di 2027 election.

Meanwhile, di FCT Minister also tell tori pipo say PDP no dey divided even though e get pipo wey no dey happy for inside di party.

Wike also confam say reconciliation tok dey go on even as di planning for di national convention also dey go on.

ADC national convention on 14 April

Di Africa Democratic Congress, wey don come out as di leading opposition political party for Nigeria, hold dia National Executive Council (NEC) meeting on Tuesday, wia dem agree dates for dia congresses for di various local govments and States ahead of dia national congress.

According to di ADC tok-tok pesin Bolaji Abdullahi, di ward congressesgo hold on 7 April, di LG own na 9 April, di state own na on 11 April, while dia national convention go be for Abuja on 14 April, 2026.

Di national convention no go be for election of party officers or for primary election, according to explanation wey oga Bolaji give tori pipo. E go be just to ratify di major decisions wey di NEC and di National Working Commission (NWC) bin don make.

LP zone presidential candidate to South

Di Labour Party also don dey ginger diasef ahead of di general election, afta di federal high court for Abuja bin settle di leadership wahala wey almost tear di party apart.

Dat leadership tussle make di party presidential candidate for di 2023 general election, Peter Obi, dump dem and join di ADC.

Also many elected officials of LP follow Obi enta APC, including three senators: Ireti Kingigbe of di FCT, Victor Umeh of Anambra Central, and Tony Nwoye of Anambra North.

However, di party retain dia one guvnor wey be. Alex Otti of Abia State, as well as some federal lawmakers from Abia State.

Currently, di leadership of LP dey for di hand of former Minister Nenadi Usman who di courts recognise as di main leadership.

On Tuesday, afta meeting wit Inec oga dem, Madam Usman tell tori pipo say di party don dey ready di general election, and one ogbonge decision wey dem don make na to zone dia presidential ticket to di southern region of Nigeria.

She say: "We certainly no go field any aspirant from Northern Nigeria. We don zone di position to Southern Nigeria. Wen di aspirants come, whoeva di pipo like and vote for during di primaries go emerge as di candidate."

Di party bin fix dia national convetion to be dis Thursday, 26 March, but dem later postpone am sake of say dem wan give more of dia members opportunity to participate for dia ongoing online membership re-registration exercise.

Dem neva tok di new date wen di national convention go hold.

APGA adopt Tinubu

For di All Progressives Grand Alliance (Apga) dia national chairman, Sly Ezeokenwa, tok for TV interview on Wednesday say di party don agree to adopt Presido Tinubu as dia candidate for 2027.

Bifor now, di Anambra State guvnor Chukwuma Soludo, wey be di only APGA guvnor, don also tok say dia party go support di sitting president.

"Even bifor anybody declare interest, di party maintain di position say we go stand ideologically aligned wit not just di All Progressives Congress, but wit di 'Renewed Hope' agenda of Mr President," Ezeokenwa tok.