First female Archbishop of Canterbury don dey installed

Dame Sarah Mullally land Canterbury Cathedral

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Dame Sarah Mullally tell BBC ahead of her installation say she recognise di 'significance' of being di first female Archbishop of Canterbury
    • Author, Aleem Maqbool
    • Role, Religion editor
  • Read am in 6 mins

Di first female Archbishop of Canterbury don warn against overlooking victims wey communities affect" during her installation as di leader of di Church of England.

For her first sermon as archbishop, Dame Sarah Mullally say: "We hold victims and survivors for our hearts and for our prayers, and we must remain committed to truth, compassion, justice and action."

She also say she pray for dos wey war for di Middle East dey affect for her remarks to one congregation of about 2,000 guests for Canterbury Cathedral, wey include di Prince and Princess of Wales.

Also, nurses and carers from Canterbury attend di installation, to show Dame Sarah long career as a nurse.

Di service, wey historically dey known as enthronement, mark di symbolic start of Dame Sarah public ministry as di Archbishop of Canterbury.

Dame Sarah – wey im predecessor na Justin Welby bin resign for 2024 on top accuse of di way e take handle one serious abuse case – she tell congregation on Wednesday say: "For inside world wey conflict, suffering, and division don already scata, we gatz also acknowledge di hurt wey dey hapun close to us.

"Make we no overlook or minimise di pain wey pipo wey don suffer through di actions, inactions, or failures of pipo wey dey our own Christian churches and communities don experience."

All di previous 105 Archbishops of Canterbury be men, starting wit St Augustine for 597 AD.

Dem only begin allow women to become priests for di Church of England 32 years ago, for 1994.

Dame Sarah tell di congregation: "As I look back ova my life - at di teenage Sarah, wey put her faith in God and make commitment to follow Jesus, I no fit ever imagine di future wey lay ahead, and surely no be dis ministry wey I now dey called to serve."

Dame Sarah bin tell BBC ahead of di service say she recognise "di significance of being di first female archbishop, but I also dey aware of di women wey don support me for my ministry".

She say di installation go give di sense of being "about celebrating women".

Di Prince of Wales and Catherine, Princess of Wales represent King Charles for di service on Wednesday

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Di Prince and Princess of Wales represent King Charles for di service

Some traditionalists for di Church of England plus di wider global Anglican Communion, continue to kick against di idea of women being priests at all.

For one meeting earlier dis month for Nigeria capital Abuja, conservative clergy bin gada to select dia own leader wey dem go follow instead of Dame Sarah, di Rwandan Archbishop Laurent Mbanda.

Dame Sarah go also work wit bishops for England wey dia beliefs mean say dem refuse to ordain women.

Members of di clergy stand and wait inside di cathedral

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, Members of di clergy bin gada for Canterbury Cathedral ahead of di installation, historically known as an enthronement
Members of di clergy waka through one courtyard for a line of two rows

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Dem invite about 2,000 pipo to attend di religious service

Oda challenges di new archbishop go face dey more familiar for leaders of di Church of England.

Controversy dey ginger on top same-sex unions for di Church, especially wit Welby resignation, plenty checkmates go dey ground on di way she go take lead on safeguarding.

"My prayers and my mind go continue to remain wit victims and survivors of abuse, and di Church don try to improve on wetin we dey do," she tok di day bifor her installation service.

"Light suppose shine on all our actions. And di more we grow, na so di light suppose shine."

Dame Sarah say: "I dey bicom di archbishop sake of di experiences wey I don get, weda as a nurse or as a priest or as a bishop. And I continue to make my commitment to do evritin wey I fit do to ensure say di Church become safer."

Sir Keir Starmer dey look from one pew inside Canterbury Cathedral wit solemn expression

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, UK Prime Minister Sir Keir Starmer also dey in attendance
Floor plan of Canterbury Cathedral wit three areas dey highlighted. Dem label di  choir on di left of di plan. Dem mark di Chair of St Augustine for di upper central section alongside one photo of di ornate seat. Dem label di Nave for di lower central section wit one photo wey show im long, vaulted interior. Di West Door dey marked for di bottom of di plan.

For di days wey lead up to di service, Dame Sarah bin waka nearly 90 miles ova six days inside one pilgrimage from St Paul Cathedral to Canterbury Cathedral.

Di theme of pilgrimage bin continue into Wednesday afternoon installation service too, and dem perform religious rites for locations throughout di cathedral.

E start wit Dame Sarah knocking three times on di West Door of di cathedral wit her pastoral staff, afta dat, local schoolchildren welcome her.

For di nave, she bin swear oath on di Saint John Bible, di first time dem go use new bible since 1945, many see am as a reflection of modernisation.

For di choir, she dey installed as Bishop of di Diocese of Canterbury for di "Cathedral Chair" before she move go di famous "Chair of St Augustine" to dey installed as Primate of All England.

While di service dey rooted in historical significance, Na Dame Sarah choose some of di hymns dem sing.

Di installation ceremony also reflect di diversity of di global Anglican Communion - as dem sing in Urdu, dem read one Gospel for Spanish and lead prayer for di Bemba language of Zambia.

Former NHS nurse wey bicom di first female Bishop of London - who be Sarah Mullally?

Sarah Mullally na one former chief nurse wey spend ova 35 years for di NHS before she become priest.

While she make history becoming di first female Archbishop of Canterbury, dis no be di first time she go break di glass ceiling for her career.

During her NHS career, she become di youngest-ever chief nursing officer for England for 1999. Mullally bin dey volunteer for di Church at di time, but na few years later she decide to become priest and dem quickly task her wit helping to make changes for di way di institution dey take deal wit abuse.

For 2012, she become canon treasurer for Salisbury Cathedral before she become Bishop of Crediton for di diocese of Exeter for 2015.

Six years later, dem appoint her as di first female Bishop of London - di third most senior member of clergy for di Church of England.

For dis role, dem see her as pesin wey use her experience as NHS administrator to help modernise di diocese.

63-year-old Mullally dey married and she get two children.

Get in touch

Are you in Canterbury for the installation of the new Archbishop?