France uninvite South Africa from G7 summit sake of Trump? How Ramaphosa reply
Wia dis foto come from, Reuters
- Author, Nobuhle Simelane
- Reporting from, Johannesburg
- Author, Wycliffe Muia
- Read am in 5 mins
US Secretary of State Marco Rubio follow for di G7 foreign ministers wey show face for France for di tok-tok wey dey hapun wia di US-Israeli war wit Iran be di main focus.
Rubio afta di G7 meeting of foreign ministers tok say di US expect to end dia operation for Iran in "weeks, not months",.
Im add say di US fit achieve dia goals "without any ground troops" wey dem go deploy to Iran, e say Tehran fit decide to set up a tolling system for di Strait of Hormuz
Di G7 ministers also demand for immediate end to attacks on civilians for di Iran war and say na "absolute necessity" to reopen di Strait, one of di busiest oil shipping channels for di world.
Dem also tok about di war for Ukraine.
Dem uninvite South Africa?
Before di summit though, tori about whether France - di host bin uninvite South Africa to attend di summit bin don dey make news.
Apart from di US oda G7 kontris na – di UK, Canada, France, Germany, Italy and Japan.
South Africa wey be member of di G20 na a regular guest for past G7 summits.
But di South African President no take di tok say dem withdraw im invitation to di G7 summit for France serious.
Ramaphosa say if pesin wey no be member of di bloc no attend di summit e no suppose to surprise anybody.
Di tori be say di US bin put serious pressure on France to withdraw Ramaphosa invitation to attend di summit wey dem schedule for June.
Di claim na say di US President Donald Trump bin threatened to boycott di summit if di South African leader show face.
"Di invitation to di G7 no mean say dem dey snub you if dem no invite you or dem ignore you," Ramaphosa tok.
France don, however, deny di claim say dem agree to any US pressure, dem say na Kenya dem decide to invite dis time.
France, wey hold di presidency of di Group of Seven (G7) industrialised nations, tok on Thursday say dem go host leaders from South Korea and three oda non-member kontris - India, Brazil and Kenya - for dia annual summit for Évian-les-Bains.
Dem say di invitations na part of efforts to "correct global economic imbalances".
One South African official bin tok on Thursday say, dem remove dem from di summit afta dem bin initially invite dem as e cite "sustained pressure from di US".
"Dem no fit risk missing a member of di G7, na why dem withdraw di invitation, wey President [Emmanuel] Macron bin personally extend to President Ramaphosa last year during di G20 summit here for Johannesburg," Vincent Magwenya, wey be di presidency spokesperson tok.
But few hours later, Ramaphosa say according to "di information im get" pressure bin no dey at all "no pressure from any kontri".
"Dem no dey invite so many kontris around di world for di G7, and we no be member. Wen we dey go, na invite dem dey invite us, and we dey carry our message go dia," na wetin Ramaphosa wey bin don attend several G7 summits as guest of di host nation tok.
Im add say South Africa neva attend evri G7 summit and say if dem no attend di June summit, "e no suppose come as surprise to anyone".
French Foreign Minister Jean-Noel Barrot bin tell di AFP news agency say im kontri "no yield to any pressure" but dem choose to "streamline G7," and na Kenya dem invite instead, to help prepare di France-Africa summit for Nairobi in May.
"We no ask di French to exclude South Africa from di G7 Summit," one State Department official tell di agency.
One White House official tell Reuters say di decision to invite Kenya bin come afta tok-tok among G7 members.
Macron dey due to visit Kenya for May for di two-day Africa-France summit.
Relations between di US and South Africa don drop since Trump enta office last year, and di two sides dey clash over trade, diplomacy and South Africa strategic partnerships.
Trump dey openly critical of Ramaphosa govment, as e dey accuse am say e dey fail to protect di white minority for di kontri and e also criticise dia land reform plans.
Di South African govment, meanwhile, dey criticise di US decision to prioritise refugee applications from white Afrikaners, e say claims of white genocide dey widely discredited and e lack reliable evidence.
Tensions between di two kontris worse last year wen di US bin impose di highest tariffs of any African kontri to South Africa.
Earlier dis month, South Africa bin summon di new US ambassador Brent Bozell to explain im "undiplomatic remarks" about di racial policies and court decisions for Pretoria.
Bozell bin appear to later backtrack, im say di US govment respect di independence and findings of South Africa judiciary.
On Thursday, di South African presidency spokesperson bin tok say "process to reset di relationship wit di US still dey go on".
"Our bilateral relationship wit France remain strong and we no go dey impacted by di withdrawal of di invitation to attend di G7 Summit," im add.
Top Tori
Informate me
Di one wey dem dey read well well
Content is not available