Senegal parade Afcon trophy despite title controversy

Senegal players parade di Africa Cup of Nations trophy

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Wetin we call dis foto, Senegal don lodged appeal wit di Court of Arbitration for Sport afta dem comot di Africa Cup of Nations title from dem
    • Author, Phil Cartwright
    • Role, BBC Sport journalist
  • Read am in 3 mins

Senegal parade di Africa Cup of Nations trophy before dia Saturday friendly match against Peru for Stade de France – despite say dem comot di title from dem early dis month.

Morocco na im dem declare as winners of di 2025 Afcon tournament wen di Confederation of African Football (Caf) overturn di result of January final.

Senegal players bin leave di field in protest wen, wit di score at 0-0, host Morocco get stoppage-time penalty.

Wen dem return afta delay of about 17 minutes, Morocco subsequently fail to score di penalty kick and Senegal net extra-time winner.

Sake of appeal by di Moroccan FA (FRMF), Caf later rule say Senegal forfeit di match and dem award Morocco a 3-0 victory.

Senegal don lodge appeal wit di Court of Arbitration for Sport (Cas), wey say dem go rule on di mata "as fast as possible".

Before di match against Peru, captain Kalidou Koulibaly and im team-mates enter di pitch wit di Afcon trophy for a lap of honour, before Koulibaly and goalkeeper Edouard Mendy go up to di stadium presidential box to keep di trophy dia.

Di friendly for Paris na Senegal first match since di Afcon final and e form part of dia preparation for di World Cup, wey go start for June.

Dem don put dem for di same group as France, Norway and either Bolivia or Iraq.