Senegal drag Caf go Court of Arbitration for Sports to challenge 2025 Afcon title decision

Wia dis foto come from, Defodi Images via Getty Images
Champions of di 2025 Africa Cup of Nations, Senegal don drag di Confederation of Africa Football [Caf] go court sake of di Afcon title.
Di Court of Arbitration for Sports [Cas] confam on Wednesday say true -true Senegal don submit appeal to dem wey fit overturn di decision wey Caf make last week.
Di 2025 Afcon tournament bin hapun for Morocco for January 2026 and Senegal beat Morocco 1-0 to win afta small kasala bin happun
But on Tuesday 17 March, 2026 Caf announce say dem dey withdraw di title win from Senegal and di West African nation immediately reject di decision and promise to go court
Pipo begin dey ask question weda Senegal go return di 2025 Afcon trophy to Morocco? But evritime still remain as e be until di Sports court rule on di mata.
For statement wey Cas release on Wednesday 25 March, di highest court for sports confam say Senegal don register dia appeal.
"Di Court of Arbitration for Sport (Cas) confam say we don receive one appeal by
di Senegalese Football Federation (FSF) against di Confederation of African Football (Caf) and di Royal Moroccan Football Federation.
Di appeal concern one CAF decision on 17 March 2026 wey declare say di Senegal national team forfeited di final of di Africa Cup of Nations (Afcon) Morocco 2025 and dem record di Moroccan national team as di winners of di match by 3-0."
Di statement go on to tok say di appeal by Senegal dey seek to set aside di decision wey Caf make.
"Registered by Cas on 25 March 2026, di FSF appeal seek to set aside di Caf decision and declare di FSF winners of Afcon. E also request an immediate suspension of di time limit to submit an appeal brief until di Caf decision dey notified wit full grounds. Di CAF decision rendered on 17
March 2026 was operative only.
Cas tok say dem go appoint an Arbitral Panel wey go consider dis mata and dem go establish a procedural calendar.
'We dey perfectly equipped to settle dis kain kasala' - Cas tok
According to Cas procedural rules, appellant get twenty days to file an
appeal brief wit legal arguments, and di respondents get twenty days to submit dia
answer wit dia statement of defence.
Cas tok say for dis early stage of proceedings and considering di request wey di FSF make to suspend deadlines, e no dey possible to anticipate a procedural timeline and to indicate wen dem go schedule di hearing.
Cas director general don tok say: "Cas dey perfectly equipped to resolve dis type of kasala, with di assistance of expert and independent arbitrators.
We understand say teams and fans dey eager to know di final decision, and we go ensure say we conduct am sharp-sharp as soon as possible, while we respect di right of all parties to get fair hearing."









