Uefa Champions league quarterfinals fixtures and dates

Wia dis foto come from, Warren Little/Getty Images)
Arsenal wey be one of di Premier League sides wey qualify for di quarter-finals of di Uefa Champions league go face Sporting Club of Portugal for di next round.
Liverpool go kwanta wit defending champions Paris Saint Germaine (PSG).
Di next round of di Uefa Champions League go begin on Tuesday 7 April to 15 April 2026.
Out of di six Premier League clubs wey qualify for di Round of 16, na only two, Liverpool and Arsenal wey remain for di competition.
Di Round of 16 conclude on Wednesday 17 March, 2026.
Quarter - final pairings and fixtures
7th April
Sporting Club vs Arsenal
Real Madrid vs Bayern Munich
End of Di one wey oda users dey read well well
8th April
Barcelona vs Paris Saint-Germain
Atlético de Madrid vs Liverpool
14 April
Atlético de Madrid vs Barcelona
Liverpool vs Paris Saint-Germain
15 April
Arsenal vs Sporting Clube de Portugal
Bayern Munich vs Real Madrid
Di clubs wey win go progress to di semi -final stage.
How dem take reach hia?
Arsenal top di league phase for di Champions League wey automatically qualify dem for di Round of 16. Bayern Munich finish second while Liverpool na third.
Barcelona bin dey fifth position while Sporting CP conclude dia run for seventh position.
Di likes of Real Madrid, PSG and Atletico Madrid finish below eighth position.
For di Round of 16 wey just end on Wednesday, Real Madrid sama Manchester City 5-1 on aggregate.
Defending champions PSG knack World champions Chelsea wetin no good, na 8-2 aggregate di match end.
Arsenal beat Bayer Levekusen 3-1 for di two legs while Sporting Club sama Bodo\Glimt 5-0.
For di oda matches Atletico Madrid qualify afta dem knack Tottenham 7-5.
Liverpool come from one goal defeat to beat Turkish giants Galatasaray 4-1, Barcelona whip Newcastle United 8-3 on aggregate.













