Arsenal, Newcastle survive but Chelsea, oda English clubs collect for first leg of Champions League Round of 16

Wia dis foto come from, ANGEL MARTINEZ/GETTY IMAGES
Real Madrid don carry one leg enta di quarterfinal of di Champions league afta dem sama Manchester City 3-0 for di Bernabeu.
Manchester City enta di game as favourites sake of dem bin dey form wey dem get all dia players fit.
Real Madrid dey without dia top scorer Kylian Mbappe, Jude Bellingham, Eder Militao among odas.
But afta 90 minutes na Real Madrid wey win di game convincingly - in fact, dem fit win 4-0 bifor but Vinicius Jnr miss im penalty afta goalkeeper Donarumma bin foul am.
Federico Valverde score impressive hattrick from di Real Madrid attacks for di game.
Di round 16 tie between dis two teams almost dey over wit dis scoreline.
Real Madrid dey expected to progress to di quarterfinal unless miracle happun for di Etihad stadium next week.
Man City coach Pep Guardiola say im decide to use Jeremy Doku and Savinho for di game to stretch di Real Madrid team but dat tactics neva work.
Im add say "at least di game no end 4-0, dis mean say we get chance for Etihad, we go try our best for dat game."
For di 2025 season, Real Madrid bin progress afta dem beat Manchester City home and away (3-1 and 2-3) for di playoff.
Experts say Real Madrid dey set to qualify again to di next stage wit dis first leg result.
PSG scata Chelsea 5-2 for Paris

Wia dis foto come from, JEAN CATUFFE/GETTY IMAGES
Paris Saint Germain use di first leg of di round 16 clash to get dia revenge against Chelsea wey be current club world cup champions.
Di game between di two teams bin dey poised at 2-2 bifor dem carry Kvaratskheilia enta di game.
Im change di game for di last 30 minutes when im enta to score two goals and grab one assit.
Di game end 5-2 - Barcola x Dembele x Vitinha x Kvaratskheilia (2) and Gusto x Enzo.
Chelsea go need at least three unanswered goals for Stamford Bridge to send di game to extra time.
PSG go tink say dem get one leg for di quarterfinal.
Arsenal get late penalty to secure 1-1 draw wit Bayer Leverkusen
Arsenal keep am late before dem manage to score one goal against Bayer Leverkusen.
Di premier League leaders bin dey dominate play but German side Leverkusen no give dem chance especially for second half.
Bayer Leverkusen use corner kick to get dia goal v Arsenal (wey be corner kick champions).
Robert Andrich bin nod di ball past goalkeeper Raya from di corner kick.
Afta di goal, Arsenal struggle to enta di game again, until dem get beta chance wen Bayer Leverkusen player foul Noni Madueke for di goal area.
Kai Havertz score from di penalty kick as Arsenal draw Bayer Leverkusen 1-1.
Arsenal go host Bayer Leverkusen for di Emirate stadium on Tuesday 17 March

Wia dis foto come from, PAU BARRENA/GETTY IMAGES
Bodoe/Glimt beat Sporting CP 3-0
Norwegian club Bodoe/Glimt win dia fifth straight champions league game 3-0 against Sporting CP.
Sporting bin finish seventh for di group phase of di competition bifor dem meet Bodoe.
Sondre Fet, Ole Blomberg and Kasper Hogh score di goals for Bodoe.
Bodeo continue dia giant-killer instincts for di competition so far - dem already defeat Manchester City, Inter Milan home and away, Atletico Madrid so far dis season.
Bodeo go face Sporting for di second leg for Portugal next Tuesday. If dem fit progress, dem go meet either Arsenal or Bayer Leverkusen for di quarterfinal.
UEFA Champions League last 16 first leg results
Results of 10 March games
- Galatasaray 1-0 Liverpool
- Atalanta 1-6 Bayern Munich
- Atletico Madrid 5-2 Tottenham Hotspur
- Newcastle United 1-1 Barcelona
Results for 11 March
- Bayer Leverkusen 1 v 1 Arsenal
- Bodø / Glimt 3-0 Sporting CP
- Paris Saint-Germain 5-2 Chelsea
- Real Madrid 3-0 Manchester City
Who be di Champions League favourites?
Arsenal finish top of di league phase as dem be di only team to win all eight games, while Bayern Munich dey three points behind for second.
If dem get past Leverkusen, Arsenal go face either Sporting or Bodo/Glimt for di quarter-finals.
Opta rate Mikel Arteta team as favourites to win dis season competition - by some distance.
Dem give di Gunnners 27.40% chance to dey crowned as European champions for di first time, wit Bayern ranked next best at 14.28%.
Liverpool wit 12.83%) na third favourites and Man City wit 10.79% dey seen as say dem get far better chance of wining di Champions League dan record 15-time winners Real Madrid wit 2.78%.
Chelsea get 6.86% and dem also get better chance dia dia last-16 opponents PSG wit 4.64%.
Tottenham, wey qualify for di Champions League by winning last season Europa League, fit face north London rivals Arsenal for di semi-finals but dem get 1.22% chance of winning.






