Wetin new US Ambassador to South Africa do wey cause controversy

Wia dis foto come from, Getty Images
Di South African govment don summon di new US ambassador, Brent Dozell afta e make comment wey dem describe as "undiplomatic" about one anti-apartheid chant.
Leo Brent Bozell III na di new US ambassador wey enta gbege wit South African pipo.
E bin start im role last month but di wahala begin wen e disagree wit one legal ruling.
Di ruling na di chant 'Kill The Boer', wey some say di chant dey amount to hate speech, although di Constitutional Court rule previously say no be hate speech.
On Tuesday, Bozell address business meeting for di coastal town of Hermanus, wia e present five issues wey e tok say South Africa need to fix.
Di argument na ova di chant and Bozell say e no care wetin di courts say. Na dat comments pipo take vex say e dey show lack of regard for di kontri legal system.
South African govment issue formal protest wey dey known as demarche. Dem say Bozell comments no go well.
Meanwhile, di US ambassador don issue clarification on Wednesday and anoda representative of di foreign ministry later say di ambassador don express regret and apologise for wetin e tok.
Bozell later say e dey ''willing to work wit South Africa constructively'' and add say ''di US govment respect di independence of South Africa judiciary''.
For one press conference on Wednesday, di South African govment announce say dem don call di US ambassador to Pretoria, to explain im recent undiplomatic comment.
Ronald Lamola add say di relationship between South Africa and US no dey one-sided.
''South African companies maintain significant investment for di United States," Lamola tok.
"Mr Bozell express im regrets say dis comments no go stop di impression say e wan work wit us constructively," Zane Dangor, di director-general of the Department of International Relations and Cooperation, tok later.
Relations between di US and South Africa don go down since US President Donald Trump take office last year, wit di two sides clashing ova trade, diplomacy and South Africa strategic partnerships.
Trump dey openly critical of South Africa President Cyril Ramaphosa govment, afta e accuse am of failing to protect di kontri white minority and criticise dia land reform plans.
Di South African govment, meanwhile, don also criticise di US decision to prioritise refugee applications from white Afrikaners.
Dem say claims of white genocide no get reliable evidence.
Julius Malema party and South Africa ruling ANC react
South African political party, Economic Freedom Fighters (EFF) don condemn di comment by di US ambassador.
Julius Malema party say di US no fit control wetin dey go on for South Africa.
"Di EFF therefore take dis opportunity to inform Bozell say di US get no say for wetin constitute South Africa domestic and foreign policy."
Also, Fikile Mbalula di ANC secretary-general say South Africa international relations policy 'no go dey dictated by anyone else but South Africans and dia govment.
Di ANC secretary-general say South Africa respect international law, so nobodi fit come disrespect dia own.
"Threats of investors pulling out such as Amazon, Google, VISA and Microsoft dey unfounded. Dis companies come to di G20 even though di Trump administration no show up."









