Pele pictures wey tell us about di career and life of di 'king'

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pele na one of di most celebrated personalities on di planet

Edson Arantes do Nascimento, di man, di man don die at di age of 82. Pele, di sporting legend, live on.

Despite say e retire for 1977, di Brazilian superstar dey considered to be di "the king of football" by im fellow kontrimen, and pipo bin like am even outside di pitch and dis one make am a cultural icon around di world.

Dis fotos tell di tori of im life.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Dem born Edson Arantes do Nascimento on 23 October 1940 for di city of Tres Coracoes (Three Hearts) for south-eastern Brazil. E grow up in poverty and work all kinds of jobs to helep im family. E no fit afford football, so e dey most times create one with newspapers wey e go put inside socks. One of im earliest memories na to see im papa dey cry as Brazil lose di last match of di 1950 World Cup to Uruguay for house. Young Edson come promise say e go win di trophy one day to make im papa smile.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pele make im professional debut for Brazilian side Santos FC for 1956, at di age of 15. Two years later, e dey part of Brazil 1958 World Cup squad. Despite say dem leave am out of di first two matches, Pele score six goals to helep Brazil win im first tournament. E still be di youngest perin to win a World Cup.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Brazil successfully defend di title for di 1962 World Cup for Chile - na sometin wey no common in di history of di tournament. Pele bin absent for di decisive match against Czechoslovakia, as e bin don dey injured during di group stage. For dis foto, e dey hug im national team and Santos FC teammate Zito afta di final whistle.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pele score 1,283 goals in decades as a professional footballer. E reach di milestone 1,000th for one Brazilian League match on 19 November 1969 afta converting a penalty. Crowd of journalists and fans invade di pitch to carry di player on dia shoulders.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, But di pinnacle of Pele career na winning im and Brazil third World Cup for 1970. na di first tournament dem televise live to a global audience in full technicolour. Pele remain di only player, male or female, to lift football ogbonge trophy three times.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di "King" retire from international duty for 1971 and six years later hang up im boots for good, at the age of 37. Dem prevent am from signing for European clubs during di peak of im career afta di Brazilian goment ban am from playing abroad, and e remain for di domestic league, devoted to one single club, Santos FC. But at di end of im career, Pele spend three seasons with US side New York Cosmos for di ill-fated North American Soccer League.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, But Pele go still take part for exhibition or charity matches. For 1990, at di age of 50, e even captain Brazil for 45 minutes for one friendly against a Rest of The World team for Wembley stadium in London.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Despite im retirement, Pele remain an influential presence for popular culture. US visual artist Andy Warhol, wey paint portraits of di Brazilian, once say of am say di football legend: "Pele na one of di few wey contradict my theory: instead of 15 minutes of fame, e go get 15 centuries."

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pele no ever go into football management and spend most of im post-playing days dey tour di world on various sponsorship deals. But e also work for TV and cinema, including di 1981 film, Escape to Victory, wia e share di screen with a young Sylvester Stallone.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, E also rub shoulders wit oda famous pipo from all over di world. Here, di Brazilian legend dey with di late South African leader Nelson Mandela for 2007. "To watch am play na to watch di delight of a child combined with di extraordinary grace of a man in full," Mandela tok about Pele.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Such star power dey very useful for Rio de Janeiro campaign to host di 2016 Olympic Games, di first to ever take place for South America. For dis picture, Pele dey in tears moments afta di decision to award di event to di city dey announced by di International Olympic Committee in 2009.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pele get a troubled personal life, with three marriages and five kids. Di Brazilian legend also admit say e get many affairs and "lose count" of possible children born out of wedlock. Only one of im children, Edinho, become a footballer - ironically perhaps, a goalkeeper. But Edinho spend time in jail on charges of drug trafficking and money laundering between 2005 and 2019.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pele health bin dey fail since 2012, wen e do at least two hip operations and suffer from kidney problems. For 2021, during one routine exam, doctors find malignant tumour for im colon.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Too weak to travel to Qatar, Pele get to watch di 2022 Fifa Men's World Cup on TV while e dey for hospital. Brazil national team players hold one banner with im name and picture afta dia victory against South Korea for di round of 16 on 5 December.