Man die afta community flog am over alleged abuse of 10-year old girl

Deadbolt of di man as dem dey take a go deposit for mortuary

Wia dis foto come from, Ayibatari Easterday

Wetin we call dis foto, Police dey investigate how community flog man 40 strokes and e die for allegedly defiling a 10 year old girl for Ekowe community
Read am in 4 mins

Police for Bayelsa State don arrest four pesins for di alleged murder of one 47-year-old man wey die for Ekowe community afta dem flog am.

Police tok-tok pesin DSP Musa Mohammed confam di arrest to BBC Pidgin say dem don begin investigate wetin lead to di death of di man.

Tori be say di pipo for Ekowe community flog di 47 year old man sake of say e allegedly defile a 10-year-old girl.

According to Ayibatari Easterday, di community pipo flog di 47 year old man afta e allegedly confess say e defile girl wey follow her Aunt go farm to harvest okra for di community hall.

"Di man confess say e see di young girl and her aunt wen dem bin dey go farm for morning. But as dem dey return, di aunt dey for front and di girl dey back so e catch di girl drag her go di bush side, but di girl come shout wey attract di attention of pipo nearby and dem come catch am carry am to di town hall."

Some parts of di traditional ruler house wey some pipo burn down

Wia dis foto come from, Ayibatari Easterday

Wetin we call dis foto, Di death of di man cause gnege for di community wey make some pipo go burn some parts of di trafi ruler house for Ekowe

Easterday explain say di Ekowe community get a tradition wey dey punish bad behaviour wia e be say any pesin wey dem catch say e thief or rape pesin, dem go carry am go to di 12 compounds and families wey make up di community and each compound go flog di pesin 10 strokes of di cane, making 120 strokes altogeda or di pesin go pay a N20,000 fine.

"So afta di man confess wetin e do di small girl, di youths for di community begin carry am go round di 12 compounds as tradition demand."

She say afta di first two compounds flog am 10 strokes each, di man faint and pesin buy malt give am wey revive am and dem carry am continue to di oda compounds.

Wia dem dey flog am for di fourth compound naim e faint again. Pipo think say e just dey pretend so as not to complete di flogging but peson come say e bin don faint bifor so dem carry am go in mama house.

Di mama pipo come rush am go di small health centre wey dey di community and na dia dem confam say e don die."

‘Pipo suppose allow di law take im cause’

Easterday say dis come cause serious gbege for di community wey make some pipo to destroy some parts of di Ekowe traditional ruler house so di Southern Ijaw local govment council come intervene to bring calm to di community.

"Di LG council naim carry di man deadibodi go deposit for di Federal Medical Centre FMC Mortuary for Yenagoa and report di mata to di police.

"Di community no suppose take law into dia hands becos wen pesin commit any crime, di best tin to do na to report di mata and hand di pesin over to di police and allow di law to take im cause." Easterday tok.

Di Police tok tok pesin say dem don arrest four pesin in connection wit di case and hand di mata over to di State Criminal Investigation and Department for further investigation.