Jury order Cosby to pay $19m to ex-waitress afta dem find out say im abuse am for 1972

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Sareen Habeshian
- Read am in 3 mins
One jury for California don order Bill Cosby to pay $19.25m (£14.3m) in damages give one former waitress afta dem find out say e bin drug and sexually assault am as im carry am go one of im shows ova five decades ago.
Donna Motsinger say di former star bin give am wine and one drug wey leave am weak afta e bin carry am from her house wit limousine for 1972.
Cosby, wey be 88-years bin deny Motsinger accuse plus claims like am wey comot from dozens of women for both civil and criminal cases.
Dem release am from prison for Pennsylvania for 2021 nearly three years into sentence for sex assault afta dem fling im conviction troway based on technicality.
Cosby lawyer, Jennifer Bonjean tell US tori pipo say her client go appeal Monday judgement,
Di jury for Santa Monica fit even add more money to punitive damages but dem neva decide dat one.
Motsinger, wey be 84-years now, bin dey work for one restaurant wey dem call di Trident for Sausalito, near San Francisco, and na dia celebrities dey like go dat time, including Cosby.
She accuse Cosby for her lawsuit say e bin invite her go one of im stand-up comedy shows and afta e bin pick am up to drive am go dia, e give am melecine wey she bin tink say na aspirin, na wetin court documents tok.
According to di Los Angeles Times, her legal action tok say, "next tin she know be say she bin dey go in and out of consciousness. Di last tin wey Ms Motsinger rember na flashes of light".
Di filing tok say she wake up for house, naked except for her underwear and "she bin know say Bill Cosby bin drug and rape her".
AP news agency report say, Cosby lawyer bin refuse di accuse as dem argue for court filings say Motsinger "freely admit say she bin no know wetin happun".
Im tok-tok pesin and lawyer no gree ansa BBC request for comment.
Bill Cospby na comedian wey bin get ogbonge fame for di 1980s and 90s wit im sitcom The Cosby Show but im rep scata yakata for ground afta dozens of women bin come out wit accuse of rape, sexual harassment and sexual miscondut from as early as di 1960s.
E still stand on am say all di encounters bin dey consensual.
!["Bill Cosby charges dropped": 'Court overturn Bill Cosby assault conviction', [vacated judgment order di American comedian release from prison]](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/660/cpsprodpb/5933/production/_119153822_billcosbychargesdroppedvacatedjudgmentfor'billcosbysexualassaultcases'.jpg.webp)








