Met Gala 2018: 'Pope Rihanna di first' and oda cele dresses for Met Gala

Wia dis foto come from, Reuters / Getty

Wetin we call dis foto, Nicky Minaj decide say she wan do opposite with her devil-red colour wey her dress be

Di Met Gala, wey bi charity event for di Metropolitan Museum of Art's Costume Institute, na di main social event for New York, and e dey attract fashion designers and stars from around di world.

Pipo sabi di event sake of di tickets wey dey cost well-well, di kain select pipo wey dey attend am, and di ogbonge cloth wey pipo dey wear come.

Every year dey get different theme and dis year own na Heavenly Bodies: Fashion and di Catholic Imagination, wey dem do to spotlight how Catholicism don enta fashion tey-tey.

Celebrities show for di red carpet on Monday night, with gowns wey resemble Pope own, dress wey dem take chainmail of Crusaders do and in di case of Katy Perry, angel wings wey big well-well.

Wia dis foto come from, PA

Wetin we call dis foto, Dis year, Rihanna wear gown wey resemble wetin Pope dey wear

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Sarah Jessica Parker carry di entire mata of how dem take born Jesus Christ for dress wey Dolce & Gabbana design

"Fashion and religion don enta demsef tey tey, where di two dey inspire each oda," curator Andrew Bolton talk for statement ontop di Met website.

"Although dis relationship dey complex and sometimes dem dey fight am, but e dey bring out some of di most ogbonge designs for history of fashion."

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Blake Lively say Versace, her dress designer, use more than 600 hours to make dis dress

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Takeoff, Offset, and Quavo of American hip hop trio Migos wear tuxedo wey different-different colours full

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Emmy Award winner and Master of None actress Lena Waithe wey bi gay, wear cape wey show di colours of di rainbow

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Katy Perry wear big Angel wing for bodi

All dis foto get copyright ontop.