Saudi Arabia: Women dey hail as dem comot driving ban
Wia dis foto come from, AFP
Women and Campaigners for Saudi Arabia don hail di new decree wey King Salman bin Abdul Aziz Al Saud land wey allow women to drive for the first time.
One female activist talk say na "great victory", while another talk say things "no go be di same again".
Campaigner Sahar Nassif tell BBC say she begin jump up and down plus laugh wen she hear di good news.
"I go buy my dream car, wey be convertible Mustang, and e go be black and yellow!"
Fatimah Baeshen, wey be di first woman wey go be Saudi Arabia's spokesperson for di embassy for US, put for twitter say na "di right decision for di right time".
Di country appoint Baeshen a day after King Salman bring out royal decree wey go allow women to drive motor.
Wia dis foto come from, Twitter/FatmahSBaeshen
Wia dis foto come from, Twitter/Moudhi90
Wia dis foto come from, Twitter/Ana3rabeya
Wia dis foto come from, Twitter/Saraa_Elamin
Wia dis foto come from, Manal_Alsharif
Wia dis foto come from, Twitter/Mariamkirollos
Wia dis foto come from, Twitter/O_Wedd
Top Tori
Informate me
Di one wey dem dey read well well
Content is not available