Queen Elizabeth II: Life in pictures

Wia dis foto come from, PA Media

Queen Elizabeth II bin live her life in di public eye. We go look back at her reign, from wen she be baby to heir to Britain longest-reigning monarch.

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, Dem born Elizabeth Alexandra Mary Windsor on April 21,1926, for one house off Berkeley Square for London. Na she be di first born of Albert, Duke of York - di second son of George V - and im wife, di former Lady Elizabeth Bowes-Lyon

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Wen she small, nobody see say di throne fit be her destiny

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, But, she show dat sense of responsibility from a very young age

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Elizabeth and her sister, Margaret Rose, wey dem born for 1930, go school for house

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Afta di abdication of King Edward VIII for 1936, Elizabeth's father become George VI and she become heir

Wia dis foto come from, Topical Press Agency / Getty Images

Wetin we call dis foto, During World War Two, Elizabeth and her sister Margaret bin leave Windsor. Dis picture show dem during dia broadcast to di nation for Children Hour on BBC

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Di young princess bin join di Auxiliary Territorial Service (ATS) briefly towards di end of di war, wia she learn gow to drive and service lorry

In 1

Wia dis foto come from, Bert Hardy / Getty Images

Wetin we call dis foto, For 1947 she marry her distant cousin, Philip Mountbatten, wey become Duke of Edinburgh

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, Her first pikin, Charles (for dis picture), na 1948 dem born am, followed by im sister, Anne, wey arrive for 1950

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, Elizabeth bin dey very close to her mother throughout her life. Na dem dey dis picture for 1951 wia dem attending one wedding

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, For January 1952, Elizabeth and Philip travel go overseas tour to represent her father, wey bin dey sick . Di King die for im sleep just days later.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Elizabeth return home immediately. As di new Queen at di age of 25

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, First na di King funeral. Here Queen Mary, her mother, watch as dem bring di body of George VI to Westminster Hall, London, for di lying-in-state. Queen Elizabeth stand behind her grandmother, and di Queen Mother dey left

Wia dis foto come from, Universal History Archive

Wetin we call dis foto, Then, for June 1953, Dem crown Elizabeth for Westminster Abbey
Wetin we call dis foto, Afta di coronation, Queen Elizabeth II and di Duke of Edinburgh appear for Buckingham Palace balcony and wave to di crowds

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Although Britain bin still dey suffer from post-war austerity, some commentators describe di coronation as di dawn of a new Elizabethan age. Here, Queen Elizabeth II ascends di Grand Staircase for Opera Paris, France

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, For 1957, di Queen make di first of many televised Christmas Day broadcasts to di nation

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, British society and attitude towards di monarchy bin dey change and dem replace di term "di Monarchy" wit "di Royal Family". Di Queen na im neighbours' bin dey look wen she visit di home of Oga and Madam Eddie Hammond for Crawley New Town, Sussex for 1958

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, Between official engagements Elizabeth spend time wit her family - See her and her daughter Princess Anne here for Frogmore, Windsor Castle

Wia dis foto come from, Mirrorpix / Getty Images

Wetin we call dis foto, For 1966, for Wembley, Di Queen present di Jules Rimet Trophy to England captain Bobby Moore afta im lead di team to a 4-2 World Cup final victory ova West Germany

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, For 29 October 1966, di Queen visit Welsh village of Aberfan, eight days afta one coal tip landslide scata Pantglas Junior School kill 144 pipo, 116 of dem na children. Di incident touch di Queen and e remains one of di most emotional moments of her reign

Wia dis foto come from, Mirrorpix / Getty Images

Wetin we call dis foto, For 1969, di documentary Royal Family first broadcast. Show pipo one year inside di private and public life of di Queen and her family