Sanwo-Olu: Coronavirus treatment of Babajide Sanwo-Olu of Lagos and wetin we know so far
Wia dis foto come from, Twitter/@ProfAkinAbayomi
Lagos State Govnor, Babajide Sanwo-Olu health dey improve and e go soon det free of coronavirus.
Dis na wetin di state Commissioner of Health, Akin Abayomi tok for statement wey e bin release on Tuesday, 15th December.
E tok say, for all di tests wey dem don do for im bodi, signs no dey say go get any wahala because of di Covid-19 infection.
Oga Sanwo-Olu bin test positive for di virus on Friday 12 December afta e bin come in contact with anoda confam case of di virus.
Tori be say, di govnor bin get mild symptoms wey include tiredness.
Oga Sanwo-Olu na di eighth govnor for Nigeria wey go catch di coronavirus wey so far don get 73,175 confam cases for di kontri.
Top Tori
Informate me
Di one wey dem dey read well well
Content is not available
{{rankTranslation}}