Coronavirus vaccine: Scientist say "we get for know weti di make pipo well afta deh take Cameroon Archbishop COVID-19 concoction"
Wia dis foto come from, CNA
- Author, Leocadia Bongben
- Role, BBC News Pidgin, Cameroon
Prof Sammy Bebane Choumbo, President of Cameroon Academy of Sciences don tell BBC News Pidgin say e good for know weti di change pipo dia health situation afta deh drink Archbishop Samuel Kleda e merecine.
Cameroon get 1832 cases for Covid-19, second highest for Sub-Saharan Africa, and 61 don die.
Archbishop Kleda confirm e tok for tori pipo dem yesterday say e concoction from leaves
di treat symptoms for Covid-19 for pipo pipo weh deh don bi test positive.
Kleda weh e start treat pipo wit leaves for over 30 years say deh di make give'am de merecine free for de pipo weh deh di sick.
Health Minister, Manaouda bi say e go send experts for shine eye for dis concoction but Kleda tell tori pipo say e di still wait dem.
As mimba for Cameroon Academy of Sciences, Prof. Bebane Chmbou say deh nova shiddon tok laik group but di discuss among dem about Kleda e concoction.
"We di try for contact some of Kleda e doctors for gada informate if we fit do some official clinical trials wit proper protocol so dat we fit get proof say deh merecine di cure Covid-19 signs", Bebane tok.
End of Di one wey oda users dey read well well
We know say Archbishop Kleda na man weh e bi highly respected, and logical, so e di use experience as proof as e discover say pipo weh deh take de medication don well, e add.
But, e say from science point of view deh get for check weti di make health situation for pipo weh deh take Kleda e merecine change.
"We need for make clinical trials weh deh di follow technique and rules weh science and merecine di use for confirm say de merecine di treat", e conclude.
Last week, the World Health Organization (WHO) bi say proof no dey for show say de merecine for Madagascar, weh dia president launched di cure coronavirus.
Top Tori
Informate me
Di one wey dem dey read well well
Content is not available