Police dey find driver of fuel tanker fire for Port Harcourt

Wetin we call dis foto, Food shop owner lost everitig inside di fire.
Read am in 2 mins

Police dey find di driver of di petrol tanker wey catch fire Thursday early morning come burn down many shops, event centre and church for Port Harcourt, southern Nigeria.

Pipo wey carri eye see wetin happun tell BBC News Pidgin say di tanker driver loss control as e dey drive along Eliozu Express road around 5am before e fall down begin catch fire.

Nobodi don see di driver, eyewitness tok. Rescue operations dey go on, so far no body don die but dem don block traffic for dat part of Port Harcourt.

Skip Facebook post

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post

According to Raphael Anorue wey dey drive motor along di Eliozu road see wetin happun, im say 'as di tanker jam electric pole come fall di sparks from di pole na im start di fire'.

We tori pesin wey dey on ground see photo wetin happun.

Wetin we call dis foto, Raphael see how e happun
Wetin we call dis foto, Dansville Event Centre wey di fire destroy
Wetin we call dis foto, Remains of Christ Living Miracle Church wey burn finish for di fire
Wetin we call dis Video, Ecobank tanker fire