Muslims jolificate Eid al-Adha.

Wia dis foto come from, Google

Wetin we call dis foto, Eid prayer inside Africa

Muslims all over di world today dey jolificate Eid al-Adha festival.

Di festival na to remember Prophet Ibrahim, when im agree to sacrifice im son Ishmael to God, but come use ram instead. So dat na why people dey use animal now, to show say dem remember.

Wia dis foto come from, Carmen McCain

Wetin we call dis foto, Eid al-Adha for Kano, Nigeria

Nigeria, Senegal, Ghana, Cameroun, Sierra Leone, Ivory Coast and Niger don already declare public holiday to jolificate di Eid al-Adha.

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, For inside Ashmun cattle market for Egypt, people dey come animal for the festival

Oda Muslims for oda countries for the world day use di day to jolificate for dia own way.

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Dis girl for Kashmir, wey India dey control, dey put Henna for hand

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, All dis Sheep wey dey for China capital, Beijing, don ready for customers wey wan jollificate the festival

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Women dey pray for Bandeh Aceh, Indonesia

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, As prayer go soon start for Jakarta, Indonesia, people dey wait for outside the mosque