Zimbabwe election don begin turn wahala

Wia dis foto come from, LUIS TATO

Read am in 2 mins

Police don tell pipo make dem stay for dia domot as katakata dey happun for Zimbabwe capital sake of di presidential election.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Police for Harare, on Wednesday fire tear gas to pursue supporters of opposition party MDC Alliance.

Di opposition supporters dey do we no go gree waka sake of say di Zimbabwe Electoral Commission (Zec) neva release results of di presidential election wey happun on Monday.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Protesters sidon dey wait for election result since morning, as dem hia say Zanu-PF dey win majority for parliament, dem begin protest

Security pipo dey throw water canons and tear gas as MDC Alliance supporters carri burn-fire dey block roads for centre of Harare.

Protesters carri sticks, stones and anytin wey reach dia hand and dem dey burn tyre for road.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Soldiers and oda security pipo dey try stop di protesters

As e be now police don shoot one person.

EU monitors dey worri say dem no wan release election result.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Dem don send Zimbabwe soldiers enta streets for di first time since Mugabe comot for office

Di MDC Alliance tok say authorities wan rigg di votes, dem say na dia candidate Nelson Chamisa win di election.

Zimbabwe Emmerson Mnangagwa wey dey di ruling Zanu-PF party don tell dia pipo to dey patient and calm down.

Wia dis foto come from, MARCO LONGARI

Wetin we call dis foto, Zimbabwe election: Kasala don burst