You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
France 1 - 0 Belgium: Les Bleus dey go Russia 2018 finals
France beat Belgium 1 - 0 for di first semi finals of di 2018 world cup.
Dem dey go play finals on Sunday and di winner between England and Croatia wey go happun on Wednesday na im dem go wait for.
Na only 3 times dem don meet for major tournaments, two for World Cup and na France win di three times.
Na only once Belgium don reach World Cup semi final and dat one na for 1986 wen den loose to Argentina, but France don enta semi finals six times and dem win two, draw one and loose three.
For di 2018 World Cup Belgium don win all dia matches while France draw one win odas.
France win World Cup for 1998 wen dem host am, but Belgium neva smell am before.