You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Belgium players wey quailfy to play for African kontris
As dem don comot all di African kontris from World Cup, oda kontris wan make Africa support dem.
Some pipo say France na di number six African kontri wey still dey for World Cup sake of say dem get 14 players wey qualify to still play for African kontris.
But Belgium get eight players wey still qualify to play for African kontris.
Belgium and France go play demsef for di World Cup Semi final. Who you go Support?
Romelu Lukaku
Anoda ogbonge player wey for play for Congo (di kontri of im birth) na Romelu Lukaku, but im choose to play for Belgium.
Di Manchester United striker dey lead di attack for Begium wey dey group G with England, Tunisia and Panama for World Cup.
Marouane Fellaini
Im dey play midfield for Manchester United. Im get twin broda Mansour Fellaini wey resemble am well well and be former goal keeper for wey dey for Morocco.
Mousa Dembele
Im be midfielder for Tottenham Hotspur. Im papa from Mali but im mama from Belgium wey make am choose to play for Begium National team.
End of Di one wey oda users dey read well well
Michy Batshuayi
Im qualify to play for Democratic Republic of Congo but im choose to play for Belgium for 2015 though im say im African heritage dey important to am.
Dedryck Boyata
Dis one complete African blood wey dey play for Celtic FC. E no gree play for im papa kontri, e follow Belgium come World Cup.
Nacer Chadli
For 2010, im bin dey play for Morocco but later decide to switch to Begium. Im follow Belgium go World Cup for 2014 and 2018.
Youri Tielemans
Na anoda African blood wey qualify to play for DR Congo sake of say im mama from dia, but e choose Belgium.