Bifor and afta fotos: How wildfires for Los Angeles destroy building structures

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, More dan 100,000 pipo don run comot from dia house sake of di deadly wildfires
Read am in 4 mins

Deadly wildfires don scata parts of di city of Los Angeles and di wider county, and edon destroy plenti homes and businesses including schools and places of worship.

At least 10 pipo don die for di wildfires, di California city medical examiner tok.

Dis na some of di ogbonge pictures of places wey dem snap bifor and afta di wildfires destroy dem.

Pacific Palisades

Dis rich area dey among di places wey di wildfires hit pas as residents no fit carry plenti tins of value bifor di fires pursue dem comot from dia houses.

Below na some pictures to show di kain destructions some businesses don face.

Di Palisades Charter High School na among landmarks for di Pacific Palisades area wey fire don damage.

Di popular school na im celebs like Will.i.am and Forest Whitaker bin study for. Na also wia dem feem popular movies like Carrie, Teen Wolf and Freaky Friday.

Wia dis foto come from, Palisades Charter High School/Facebook

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Tori be say Pali high school suffer ogbonge damage for di fires wey completely destroy di houses wey dey opposite am

Pacific Coast Highway

Houses wey dey near part of di major state highway don also dey hit wit di Palisades fire and e include di city of Malibu.

Satellite imagery show wetin coastline look like bifor and afta di fires bin hold.

Wia dis foto come from, Reuters

Wia dis foto come from, Reuters

Altadena

Di Eaton Fire don destroy hundreds of homes and businesses for Altadena wey dey under di mountains wey dey for id north of Los Angeles.

Below you go see di damage wey di fire cause to one house, and also a wider look for di full extent of di damage wey di area don suffer.

Sorry, we can’t display this part of the story on this lightweight mobile page.

Pasadena

For nearby Pasadena, one Jewish temple dey among di buildings wey di Eaton Fire bin chop clean mouth.

According ot dia website, di temple congregation don get history wey pass 100 years for dat area.