Colombian Air Force plane crash kpai 66 pipo as four still dey miss

Wia dis foto come from, Daniel Ortiz / AFP via Getty Images

Read am in 4 mins

Rescue workers for Colombia dey search for four pipo wey dey miss afta one military plane crash for south of di kontri.

Sixty-six members of di Colombian security forces kpai on Monday wen di Hercules C-130 transport plane crash shortly afta e take-off near di Colombia border wit Peru.

Locals na di first pipo to reach di place wia e crash as dem pull out dozens of injured survivors from di wreckage wey dey burn as dem carry di pipo wey wound for dia motorbikes go hospital

Authorities don begin chook eye for di plane to know wetin cause di accident.

Na total of 128 pipo bin dey inside di transport plane wey bin dey go from di town of Puerto Leguízamo to Puerto Asís.

For series of posts on social media, Colombian President Gustavo Petro bin appear to blame outdated military hardware for di accident.

Im bin tok about di victims, but im bin no mention di Hercules plane directly, im bin write: "Dis piece of scrap metal na for 2020 dem bin buy am and e crash, make we ask why".

For one post wey im bin make earlier, im bin blame "bureaucratic problems" say dem dey hold im plans to modernise di armed forces equipment and dia aircraft.

"I no go allow any further delays, di lives of our young pipo dey at stake," im write.

Mobile phone footage wey dem bin shared on social media show as di plane dey lose height shortly afta take-off, wetin follow am na plenti smoke wey dey rise from di crash site and di sound of explosions.

Di defence minister for Colombia say di sound bin come from ammunition on board wey blow up di flames.

Im add say no indication say di plane bin come under attack from any of di armed groups wey dey active for di Putumayo region.

One local farmer bin tell AFP news agency say im bin hear loud bang bifor di Hercules crash into trees near im house.

"I bin feel one explosion for di air and, wen I look up, di plane bin dey fly close to di house wey dey for my plot," Noé Mota tok

According to di latest death toll, 58 army personnel, six members of di air force and two police officers die for di crash, Commander General Hugo Alejandro López tok.

Di crash na di second time wey Hercules C-130 dey get deadly accident in as many months.

On 27 February, one Hercules C-130 wey belong to di Bolivian army, wey bin dey carry shipment of banknotes, overshoot di runway as e bin dey approach di airport for El Alto, for Bolivia, and e crash into traffic for one nearby highway.

Twenty-four pipo bin die for dat incident.

Earlier, BBC News Pidgin bin report say two pilots die afta one passenger plane jam one fire truck for LaGuardia Airport for New York.

Fotos from di scene show as di plane drive backwards and di cockpit almost comot for di bodi.

Debris, wreckage and warped metal full di bodi of di fire truck wey stand near am.

Authorities tok say dem don carry 41 pipo go hospital, dem later discharge 31 passengers but some suffer from serious injuries.