President Donald Trump inauguration in fotos
Wia dis foto come from, Getty Images
Donald Trump give im inaugural speech as president by addressing im fellow presidents and odas wey dey attend di event, including former Vice-President Kamala Harris and former President Joe Biden.
Di incoming President Donald Trump tok many tins including plan to declare a "national emergency" for di US-Mexico border.
Dis na as part of di many executive orders wey e intend to sign to shaparly reverse di Biden administration policies.
"Di golden age of America begin right now," im tok. "From dis day forward, our kontri go flourish and dey respected.
"I go very simply put America first."
Di new president say, "to most Americans, January 20, 2025 go be liberation day!"
Wia dis foto come from, Getty Images
'America decline is over'
Trump say dem give am mandate to "completely and totally reverse" wetin im call "horrible betrayal" by pipo in power against di American pipo.
E add say im go give pipo "dia faith, dia wealth, dia democracy and d freedom."
"From dis moment on, America decline is over," im say.
'Drill baby drill'
Di president tok about tackling inflation and rising energy costs for Americans – one main point for im campaign.
Im say im go direct all members of cabinet to do wetin dey dia power to do to "defeat" inflation and "rapidly bring down costs and prices".
Trump add say im go declare national energy emergency, and repeat im promise say im administration go drill of oil and gas on US soil.
"America go be manufacturing kontri once again," im say, adding say America dey sit on "di most oil and natural gas of any kontri on earth, and we go use am."
"Drill baby drill," im say to applause.
Wia dis foto come from, Getty Images
President hit Biden-era policies
Wia dis foto come from, Getty Images
Trump use im first speech to attack Biden administration and how e take handle migrant crisis.
E say im goment go "annihilate", di kontri challenge and confront di crisis of "trust over radical and corrupt establishment".
E say di former administration provide sanctuary and protection for "dangerous criminals" wey illegally enta di kontri.
Di goment don give "unlimited funding to defence of foreign borders" but refuse to defend American borders, im claim.
"We now have a government that cannot manage even a simple crisis at home," Trump says.
E say for im goment: "We no go forget out kontri, we no go forget our constitution, and we no go forget our God."
Trump officially swear in as president
Donald Trump officially become di 47th President of di United States.
During in swearing in, im swear to "preserve, protect and defend" di Constitution.
Dis na di first time since di 1890s wey US president wey dem bin defeat for election dey return victorious to take oath for a second time.
Cannons fire salute as dem di choir dey sing Hail to the Chief soon afta Trump take im oath.
Den dem come sing, Battle Hymn of di Republic.
Na two bibles dem take swear am into office - one wey im mama bin give am, and di Lincoln Bible.
Several oda previous presidents bin use dis bible - including Abraham Lincoln for 1861.
Wia dis foto come from, Getty Images
Wia dis foto come from, Getty Images
Wia dis foto come from, Getty Images
Wia dis foto come from, Getty Images
Wia dis foto come from, Getty Images
Wia dis foto come from, Getty Images
Wia dis foto come from, Getty Images
Wia dis foto come from, Getty Images
Wia dis foto come from, Getty Images
Wia dis foto come from, Getty Images
Wia dis foto come from, Reuters
Wia dis foto come from, EPA
Top Tori
Informate me
Di one wey dem dey read well well
Content is not available