List of kontris wey don qualify for 2026 Fifa World Cup

World Cup trophy

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di 2026 World Cup go take place for Canada, Mexico and di United States from 11 June to 19 July
Read am in 3 mins

DR Congo dey face Jamaica for di Fifa 2026 World Cup intercontinental play-offs.

Di last time wey DR Congo appear for di World Cup na 1974 wen dem compete as Zaire.

Rememba say DR Congo beat Nigeria to extend dia bid to reach di 2026 Fifa World Cup afta for di African playoff final.

Jamaica beat New Caledonia for di semi-finals of di play-offs wey dem play for Thursday, 26 March 2026.

Iraq go battle am out wit Bolivia to find dia spot for di Fifa 2026 World Cup.

Bolivia don qualify for three World Cups, including di first tournament for 1930, but dem neva get anoda opportunity since 1994.

Na six spots remain for di 2026 Fifa World Cup wey go happun for di United States, Mexico and Canada.

Four European nations go get di chance to qualify through di play-offs, and e go happun through semi-finals and den final.

Na 48 teams go compete for dis World Cup tournament wey go kick-off on Thursday 11 June 2026, and teams like England, Croatia, France, Argentina and World Cup first-timers Cape Verde, Jordan and Uzbekistan don alreadi qualify.

FIFA World Cup qualifying fixtures

Tuesday 31 March 2026

  • Bosnia-Herzegovina vs Italy
  • Czech Republic vs Denmark
  • Kosovo vs Turkey
  • Sweden vs Poland

Four winners from here go proceed go di 2026 Fifa World Cup.

Intercontinental play-offs

  • Jamaica vs DR Congo
  • Bolivia vs Iraq

Di winner of di game between Jamaica and DR Congo go face Portugal, Colombia and Uzbekistan for Group K for di World Cup.

Di winner of di game between Bolivia and Iraq go enta di tight group wit France, Senegal and Norway for Group I.

Argentina team lift di World Cup

Wia dis foto come from, Julian Finney/Getty Images

Teams wey don already qualify for 2026 World Cup

Joint-hosts Canada, Mexico and di United States get automatic qualification.

Australia, Iran, Japan, Jordan, Qatar, Saudi Arabia, South Korea and Uzbekistan don alreadi qualify from Asia.

Oceania get one direct qualification spot and New Zealand don take am.

Tunisia and Morocco na di first two African sides to go through to di World Cup, and Algeria, Cape Verde, Egypt, Ghana, Ivory Coast, Senegal and South Africa join dem.

Brazil, Ecuador, Uruguay, Paraguay and Colombia na di oda South American nations wey don guarantee dia place.

Hosts:

Canada, Mexico, United States

  • Africa (10 kontris go qualify)

Algeria, Cape Verde, Egypt, Ghana, Ivory Coast, Morocco,

Senegal, South Africa, Tunisia

  • Asia (8 kontris go qualify)

Australia, Iran, Japan, Jordan, Qatar, Saudi Arabia,

South Korea, Uzbekistan

  • Europe (16 kontris go qualify)

Croatia, England, France, Norway, Portugal, Scotland,

Spain, Switzerland, Austria, Belgium, Netherlands, Germany

  • Oceania

New Zealand

  • South America (7 kontris go qualify)

Argentina, Brazil, Colombia, Ecuador, Paraguay, Uruguay

  • North America (Six kontris go qualify)

Haiti, Panama, Curaçao

Na only di teams wey don qualify dey appear for up.