Trump tell UK and oda kontris to go collect dia own oil' from Strait of Hormuz

Wia dis foto come from, Chip Somodevilla/Getty Images)
US President Donald Trump don crash di hope of millions of pipo wey dey hope say im fit intervene to open di Strait of Hormuz so vessels wey carry oil fit pass.
Donald Trump tell di UK and oda kontris "go get your own oil" from di Strait of Hormuz
"All of una go soon start to learn how to fight for yourself, di USA no go dey dia to help una anymore, just like una bin no dey for us," na wetin e write for im Truth Social post
US Defence Secretary Pete Hegseth say di "upcoming days go dey decisive" and say more vessels dey travel through di the Strait of Hormuz - BBC Verify dey assess this claim.
Since US and Israel invade Iran, Iran respond back and one of di ways dem respond na to block di Strait of Hormuz.
Meanwhile, dem strike one Kuwaiti oil tanker wey dey carry millions of barrels of crude oil near Dubai. Officials dey blame Iran for di strike
Di 24 crew wey dey on board di vessel dey safe and dem don control di fire - BBC Verify dey check out di damage.
Tori be say new strikes and interceptions dey happun for Israel, Iran and di UAE, and plenti pipo wound sake of debris wey dey fall for Dubai.
Inside di five weeks of war, thousands of pipo don die - di highest na for Iran and Lebanon
Wetin be di Strait of Hormuz - and wia e dey?
Di Strait of Hormuz na one of di world most important shipping routes, and dia most important oil transit choke point.
To di north by Iran and to di south by Oman and di United Arab Emirates (UAE), di corridor wey be only about 50km (31 miles) wide at dia entrance and exit, and about 33km wide at dia narrowest point – connect di Gulf wit di Arabian Sea.
Di strait dey deep enof for di world biggest crude oil tankers, and dey used by di major oil and gas producers for di Middle East – and dia customers.
For 2025, about 20 million barrels of oil pass through di Strait of Hormuz per day, according to estimate from di US Energy Information Administration (EIA) – dat na nearly $600bn (£447bn) worth of energy trade per year.
Dat oil come not only from Iran, but also oda Gulf states such as Iraq, Kuwait, Qatar, Saudi Arabia and di UAE.
How Iran close di Strait
United Nations rule allow kontris make dem control of territorial seas up to 12 nautical miles (13.8 miles) from dia coastline.
At dia narrowest point, di Strait of Hormuz and dia shipping lanes lie entirely within Iran and Oman territorial waters.
E dey unclear exactly how Iran plan to shut di strait but according to experts one of di most effective ways for dem to do am go be to lay mines using fast attack boats and submarines.
Iran regular navy and di IRGC navy fit potentially launch attacks on foreign warships and commercial vessels.
Howeva, large military ships fit in turn become easy targets for US air strikes, and Trump say one of im aims na to destroy Iran navy.
Iran fast boats dey often armed wit anti-ship missiles, and di country also operate a range of surface vessels, semi-submersible craft and submarines.
How e dey impact di world
About 3,000 or so ships usually sail through di strait each month.
Analysts warn say di longer di threats to ships passing through di strait, di higher di price of oil and di shipping go be.
"Na di de facto close for dat wey no one dares to go through," Arne Lohmann Rasmussen, chief analyst for Global Risk Management, provider of energy market insights, tell CBS News, di BBC US partner, last week.
"You fit chop attack, and you fit no get insurance or e dey extremely expensive, so you gatz wait until di security situation dey better... If oil and gas come from di strait dey cut off, dat get significant ramifications for di market," e add.
"While no physical blockade dey, threats from di Iranians, plus drone and missile attacks, mean tankers no dey go through di strait."
Tok tok pesin for Iran foreign affairs ministry, Esmail Baghaei, tell CNBC on Monday say oil tankers passing through di strait "must dey very careful".
Oil go high past $100 per barrel on Monday, bifor Trump say di war dey "very far ahead of schedule" and "very complete, pretty much". Im comments lead to fall for di oil price, wey dey now closer to $90 per barrel, but e still well above pre-war levels.
According to data from di London Stock Exchange Group, di cost of hiring supertanker to ship oil from di Middle East to China don almost double from last week price to record high of more than $400,000 (£298,300).
Di almost complete closure of di vital shipping lane don also hurt Gulf countries, like Saudi Arabia, wey dia economies rely heavily on energy exports.










