Ogbonge fotos of Easter celebrations from around di world

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Pope Francis attend di Easter Mass for St. Peter's Square for Vatican

Plenti ceremonies dey take place across di world to mark di most important festival for Christian calendar - Easter.

Jesus resurrect on Easter Sunday, na so Bible tok, days afta im die on di cross on Good Friday.

Na tradition for many pipo to go church on Friday, Saturday and Sunday.

Here for Nigeria, President Bola Tinubu wish im kontri pipo Happy Easter.

Bifor we share di fine Easter celebration pictures, see President Tinubu Easter message

President Tinubu Easter message

President Bola Tinubu wish Nigerians Happy Easter, and praise dem for all di sacrifices wey dem don make due to di economic palava for di kontri.

For inside one statement, President Tinubu say: ‘’Di sacrifice of Jesus Christ for humanity na strong lesson for leaders and all Nigerians to yield to selflessness and compassion, and to dey focused towards a united, peaceful, and prosperous nation.

"I commend Nigerians for all di sacrifices dem don make for di past few months to drive di nation to di path of recovery and sustainable growth, … di seeds of patience una plant dey grow and veri soon good fruits go plenti."

President Tinubu assure all citizens say Nigeria go overcome all di challenges wey di kontri dey face and add say im administration dey fully committed ontop dis mata.

Tens of thousands of worshippers gada for St Peter's square to hear Pope Francis lead Easter Sunday Mass.

Wia dis foto come from, Reuters

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Worshippers gada for St Peter's square for Rome to hear Pope Francis lead Easter Sunday Mass

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, One small girl dress like angel act bifor di traditional procession wia di images of Jesus Christ and Mary meet, on Easter Sunday, for di St. Peter Parish Shrine of Leaders for Quezon City, Metro Manila, Philippines

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, One day afta im pull out of a ceremony on short notice, Pope Francis take part for two-hour vigil for Vatican on Saturday

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Some pipo dey concerned about im health wen im bin take part for di Good Friday procession

Wia dis foto come from, GIUSEPPE LAMI/EPA-EFE/REX/Shutterstock

Wetin we call dis foto, Im read one long homily and do baptisms ahead of im Easter message on Sunday morning

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, For di Philippines, worshippers gada along one staircase to see di traditional procession

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Children wey dress as angels been dey pray ahead of di celebrations for Metro Manila wey dey take place for night

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, For Nairobi Kiberia district, for Fort Jesus, young and old worshippers join togeda to light candle

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Na priests lead di service - dem light fires outside di church before dem move inside

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, One woman attend Easter Sunday service for di Holy Trinity Cathedral Church of Pakistan, for Karachi

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Archbishop Pierbattista Pizzaballa lead Easter Sunday Mass for di Church of di Holy Sepulchre for Jerusalem Old City

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, One Catholic priest give Holy communion to one Christian devotee during Easter Sunday service and to mark di fifth anniversary of di Easter Sunday attack, for St. Sebastian Church for Katuwapitiya.

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Easter service for Prague