Ogbonge fotos show how Orthodox Christians all ova di world celebrate Christmas on 7 January

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Ethiopian Orthodox worshippers hold candles during one Christmas Eve celebration for Bole Medhanialem Church for di capital Addis Ababa.

Many Christians for different parts of di world don enjoy Christmas and forget say dem do celebration.

However, na today, 7 January, Orthodox Christians around di world dey celebrate di birthday of Jesus Christ.

According to Orthodox calendar, na on 7 January dem born Jesus. More dan 200 million Christians around di world wey be member of Orthodox Churches dey celebrate Christmas on dis day.

Dis na because dem dey follow di Julian calendar.

Dem no dey like di Christian denominations wey dey follow di Gregorian calendar.

Ceremonies and processions mark di event wey dey happun around di world from Cairo to Moscow.

Di Orthodox Church na one of di three main Christian groups (di oda ones na di Roman Catholic and Protestant). Around 200 million pipo dey follow di Orthodox tradition.

Di Orthodox Churches dey united in faith and dem get common approach to theology, tradition, and worship. Dem draw on elements of Greek, Middle-Eastern, Russian and Slav culture.

Di majority of Orthodox Christians dey base for eastern Europe, and many dey live for Russia and Ukraine.

But in response to di ongoing war wit Russia, many Ukrainians bin celebrate Christmas on 25 December last year, afta one change for di law.

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, One woman for Bishkek for Kyrgyzstan light candle during Christmas celebrations during service for one Orthodox church.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, While most Ukrainians celebrate Christmas Day on 25 December in response to di ongoing war wit Russia, odas - like those wey dey live for Russian-controlled Donetsk - celebrate Orthodox Christmas as usual for January.

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Russian President Vladimir Putin attend di Orthodox Christmas service for di Church of the Not-Made-By-Hands Image of Christ the Saviour for Novo-Ogaryovo state residence outside Moscow, Russia.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Georgians for Tsbilisi dey take part for inside one annual procession dem call Alilo to celebrate Orthodox Christmas.

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Greek Orthodox Patriarch of Jerusalem Theophilos III lead Christmas Eve mass for di Church of di Nativity for Bethlehem - dem tok say be di birthplace of Jesus.

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Serbians for Belgrade gada around one traditional Christmas bread during di Orthodox Christmas Day celebrations.

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Children sing religious songs during one Christmas Eve service for di St. Kliment Central Orthodox Church for Skopje, North Macedonia.

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, One Coptic Orthodox clergy member waka pass worshippers as e lead Christmas Eve mass for di Angel Mikhail Coptic Orthodox Church for Cairo, Egypt. Di Coptic Orthodox Church na di largest Christian community for di Middle East.