Two pipo chop arrest afta Rapper Offset collect bullet for Florida

    • Author, Georgia Levy-Collins
    • Role, BBC Newsbeat
  • Read am in 3 mins

Dem shoot former Migos rapper Offset outside one casino for Florida, according to US media reports.

Di 34-year-old, wey im real name na Kiari Kendrell Cephus, dey for "stable" condition and dem dey "closely monitor" am for hospital, one tok-tok pesin tell Variety.

Di Seminole Police Department tell di BBC Newsbeat say di incident happun on Monday evening.

Dem don detain two pipo in connection wit di shooting, as BBC Newsbeat don contact Offset representatives for comment.

Police tok say one incident take place for "valet area" afta 19:00 on Monday, outside of Seminole Hard Rock Hollywood" and "result in non-life threatening injuries to one individual".

Di force also say di "investigation dey ongoing".

Offset dey known as part of di hip-hop trio Migos along wit Quavo and Takeoff.

E bin marry US singer and rapper Cardi B for 2017 and di couple get three children.

Dem later separate and file for divorce for 2024.

Multi-platinum group Migos first go viral wit di song Versace for 2013.

Anoda hit follow for 2017, Bad and Boujee, wey make am to anoda number one on di Billboard Hot 100.

Dem dey described as one of di most influential groups of dia generation.

For early 2022, di three of dem split as Quavo and Takeoff form dia own duo, Unc & Phew.

Offset pursue a solo career.

Months later for November 2022, dem shoot Takeoff dead for one bowling alley for Houston, Texas.

Im record label bin pay tribute to di rapper for statement: "Senseless violence and a stray bullet don take anoda life from dis world and we dey devastated."