Two pipo chop arrest afta Rapper Offset collect bullet for Florida

Offset na man, e get brown eyes and dey wear white and red cap. 
E get diamond stud earring and dey wear large silver chain. E dey wear red jacket wit black collar. E get tattoo for im cheek below im eye of a cross and tattoos on im neck.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di former Migos rapper dey reportedly for "stable" condition and dey "closely monitored" for hospital
    • Author, Georgia Levy-Collins
    • Role, BBC Newsbeat
  • Read am in 3 mins

Dem shoot former Migos rapper Offset outside one casino for Florida, according to US media reports.

Di 34-year-old, wey im real name na Kiari Kendrell Cephus, dey for "stable" condition and dem dey "closely monitor" am for hospital, one tok-tok pesin tell Variety.

Di Seminole Police Department tell di BBC Newsbeat say di incident happun on Monday evening.

Dem don detain two pipo in connection wit di shooting, as BBC Newsbeat don contact Offset representatives for comment.

Police tok say one incident take place for "valet area" afta 19:00 on Monday, outside of Seminole Hard Rock Hollywood" and "resulted in non-life threatening injuries to one individual".

Di force also say di "investigation dey ongoing".

Offset dey best known say e dey part of di hip-hop trio Migos along wit Quavo and Takeoff.

E married US singer and rapper Cardi B for 2017 and di couple get three children.

Dem later separate and file for divorce for 2024.

Multi-platinum group Migos first go viral wit di song Versace for 2013.

Anoda hit follow for 2017, Bad and Boujee, wey make am to anoda number one on di Billboard Hot 100.

Dem dey described as one of di most influential groups of dia generation.

For early 2022, di three of dem split wit Quavo and Takeoff forming dia own duo, Unc & Phew.

Offset pursue a solo career.

Months later for November 2022, dem shoot Takeoff dead for one bowling alley for Houston, Texas.

Im record label paid tribute to di rapper for statement: "Senseless violence and a stray bullet don take anoda life from dis world and we dey devastated."