Artemis II crew dey return to earth afta dem fly around di moon

Wia dis foto come from, NASA
Di Artemis crew don ready to come back to earth afta dem make history for flying to di farthest area wey any human pesin don reach bifor as well as seeing total solar eclipse from dia spacecraft during a lunar flyby.
Commander Reid Wiseman tok say di Orion spacecraft crew "don see tins wey no human don eva see" even as di pilot tok say adjectives no dey to describe wetin dem see.
Di crew dey expected to land for di Pacific Ocean for 20:07 eastern US time for Friday, 10 April (01:07 BST 11 April).
Di spaceship reach di maximum distance from earth wey be 252,756 miles (406,771km) according to Nasa during dis lunar flyby. Di crew bin don alreadi break record of di most distance wey human beings don fly for space.
Di astronauts bin lose connection wit Nasa wen dem bin dey behind di move. Di disconnection bin last for 40 minutes but e bin dey expected.
As soon as dem reconnect, di mission specialist Christiana Koch tok say "e dey great to hear from earth again".
US President Donald Trump for surprise appearance bin congratulate di astronauts say dem don "make history and make all of America really proud".
E add say, "Notin be like wetin una dey do, circling di moon for di first time in ova half a century, and breaking di all time record for di farthest distance from planet earth."
"Humans neva really seen anytin wey be like wetin una dey do. E dey really special", na wetin Trump add as e invite di astronauts come White House.
Astronaut Victor Glover tell di president say e tok "small prayer" wen di spacecraft bin lose contact wit Nasa small.
But dem also tok about mars through out di call, Commander Reid Wiseman tell di president say all di crew bin don tok about "how we dey excited to watch dis kontri and dis planet turn to to two planet species".
As at di time of dis tori, di Orion spacecraft don complete dia moon flyby and reach di farthest distance wey human beings don take comot from earth.
Di crew still dey like 244,200 miles (393,002 km) from Earth and once dem land Earth, dem go don travel ova 695,000 miles (1,118,494km) in total.
Wetin di Artemis crew goal be for dis moon mission
Artemis II crew wey get four pipo na Nasa commander Reid Wiseman, pilot Victor Glover and mission specialist Christina Koch. Dem get second mission specialist, Jeremy Hansen from di Canada Space Agency, wey also dey on board.
Di mission dey involve di first crewed flight of Nasa gigantic Space Launch System (SLS) rocket and di Orion space capsule.
Once dem dey safe on top di orbit, di astronauts go test how di Orion handles dey work. Dis dey involve manually flying di capsule for di Earth orbit to dey practise how to steer and line up di spacecraft Moon landing for di future.
Dem now go comot to one place wey be thousands of kilometres beyond di Moon to check Orion life‑support, propulsion, power and navigation systems.
Di crew go also act as medical test subjects, dem go send di data and images back from deep inside space.
Dem go work inside small cabin wey no get plenti weight. Di Radiation level go also dey higher dan wetin dey on top di ISS, wey dey for low-earth orbit, but wey still dey safe.
Wen dem return to Earth, di astronauts go experience wetin be one bumpy return through di atmosphere and splashdown off di west coast of di US, for di Pacific.
But dem no land for di moon. Di mission na to lay di ground for di lunar landing by astronauts for di Artemis IV mission, wey dem plan for 2028.
Wetin be di plans for di next four days as dem dey on dia way back to earth?
Pictures, audio and oda data wey dem collect from di lunar flyby dey dey downlinked by Mission Control.
Di first pictures from di flight neva appear for di Nasa website but dem go soon land,
For flight day seven, di spacecraft go comot from di lunar sphere of influence and na our planet gravitational pull go take ova begin dey pull di spacecraft come back earth.
Retired Nasa astronaut Terry Virts, wey bin work as di commander of di International Space Station explain why di crew of di shuttle bin need allow gravity take ova so dem go fit do dia round about around di moon.
E tok say, "Dem allow di moon gravity to bend di shape of dia trajectory 180 degrees and bring dem back to earth. So no be like say dem go do one big complicated manoeuvre."
But e tok say "dem dey deep space wit no way to dey rescued and dem get di harshest radiation wey no even exist for earth, dem dey surrounded by death just few millimetres outside di thin aluminium shell".
Do Orion Crew go follow di astronauts for di International Space Station, den di lunar science team and di astronauts go fit tok wetin dem see for di flyby.










