Cameroonian lawmakers approve creation of Vice President post

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
Lawmakers for Cameroon don adopt one bill to reintroduce di post of Vice President wey dem scrap ova 50 years ago, amid uncertainty ova who go succeed President Paul Biya.
During today vote, 200 members of parliament bin dey favour of di constitutional amendment, 18 bin vote agains am, while four abstain.
Once President Paul Biya promulgate am into into law, di kontri vice president fit dey appointed.
Ogbonge opposition leader Maurice Kamto bin call di bill attempt at power grab.
"We gatz prevent di political turmoil afflicting our kontri from taking root. Togeda, we must clearly and loudly express our rejection of di ongoing constitutional and institutional coup," Kamto tok for one video address.
If President Biya promulgate am, di vice president go take ova in di event of di president death, resignation or incapacity wit no obligation to hold elections.
Supporters of di amendment say di move go strengthen institutional stability and ensure continuity in leadership.
Last year October, Cameroon Constitutional Council bin declare President Paul Biya di winner of di October 12 election.
Biya win wit 53.66% percent of di votes, while im main challenger and former ally Issa Tchiroma Bakary come second wit 35.19% percent, di Constitutional Council tok.
"Di candidate Biya Paul hereby dey declared elected president of di republic, afta e obtain majority of di votes cast," Clement Atangana, President of di Constitutional Council, announce.
Dem put voter turnout at 57.76%, wit abstention rate of 42.24%.
Ten candidates bin run for di kontri top job, and Biya wey neva lose election bifor bin already dey considered as favourite to win.
Dis results different from di ones wey Issa Tchiroma wey declare imsef as winner of di election beforehand get.
We dey update dis tori









