Who be Christopher LaNeve, di man wey go lead di US army for di middle of war wit Iran?

LaNeve dey tok into one small microphone wey dey on top one stand for im front. E wear small glasses and im military uniform wey carry several awards on am.
    • Author, Imogen James
  • Read am in 4 mins

General Christopher LaNeve don ready to bicom acting Chief of Staff of di US Army, according to CBS News, BBC US partner.

Im appointment come afta US Defence Secretary Pete Hegseth ask Randy George to step down from di post, wey e don hold since 2023.

Di role na di most senior position for di Army, and office holders usually dey serve four years term.

Pentagon tok-tok pesin Sean Parnell announce say LaNeve, wey be di Vice Chief of Staff, na "battle-tested leader wey get decades of operational experience and Secretary Hegseth completely trust am to carry out di vision of dis administration witout fault".

Di appointment dey come for di middle of war for Iran, and part of one wider shake up of di US military wey Hegseth dey in charge of since e enta di Pentagon.

E don fire more dan one dozen senior leaders in just ova one year, wey LaNeve don benefit from, as e move into more senior roles within di Pentagon.

Dis new appointment go mark im third career move under Hegseth.

Dem appoint am as Vice Chief of Staff for February 2026, afta James Mingus retire from di role early.

Upon dat appointment, Hegseth bin describe am as "a generational leader" wey go "help ensure say di Army revive di warrior ethos, rebuild for di modern battlefield, and stop our enemies around di world".

Bifor dat, LaNeve bin serve as senior military assistant to Hegseth, one role wey e serve since April 2025.

E bin replace Lt Gen Jennifer Short, wey Hegseth sack just few months afta e enta di Pentagon.

LaNeve don hold several oda high-level positions for di military, wey e join from di University of Arizona for 1990.

Ova im 36 years of service, LaNeve don lead several teams, wey include di Eighth Army for South Korea and di 82nd Airborne Division.

E also don serve for multiple deployment combat missions, including for Afghanistan and Iraq.

Why Hegseth ask US Army top general to step down

US Defense Secretary Pete Hegseth bin ask Army Chief of Staff Randy George to step down from im post, according to CBS News, di BBC US partner.

Chief Pentagon tok-tok pesin Sean Parnell tok for one statement on social media say George "go retire from im position as di 41st Chief of Staff of di Army effective immediately".

Di Army chief normally dey serve a four-year term. George, wey be career military officer wey graduate from di West Point military academy, bin dey nominated by former President Joe Biden for di role for 2023.

Dis latest shakeup dey come afta Trump tok for one address to di nation say di US-Israel war wit Iran dey expected to end "veri shortly".

George bin serve as infantry officer for di first Gulf War and in recent conflicts for Iraq and Afghanistan.

E neva dey immediately clear why dem ask am to leave.

"We dey grateful for im service, but time don reach for leadership change for di Army," one unnamed senior defence official tell CBS.

Pentagon tok-tok pesin Parnell say: "Di Department of War dey grateful for General George decades of service to our nation. We wish am well for im retirement."

E go dey replaced by Army Vice Chief of Staff Gen Christopher LaNeve wey go bicom di acting army chief of staff, according to US media.

Di US Military Academy for West Point bin post fotos on Wednesday of George meeting wit troops, wia e say im "share experience-driven guidance wit cadets wey dey prepare to lead".

Since e enta di Pentagon, Hegseth don fire more dan one dozen senior military officers, including di Chief of Naval Operations plus di Air Force Vice Chief of Staff.