Fresh violence for Jos Plateau State afta Angwan Rukuba attack wey kill more dan 20 pipo

Map of Nigeria showing Jos Plateau State
Read am in 4 mins

Residents for some areas for Jos, di capital of Plateau State, for di north central region of Nigeria, dey for fear sake of anoda violence wey hapun for dia dis Wednesday.

Dis dey happun just days afta one attack by some armed men for Angwan Rukuba community for Jos North local govment area, wey lead to di death of least 26 people and cause di govment to put curfew for di area.

Wednesday attack happun for some areas for Jos metropolis as local tori pipo say at least one pesin don kpai and panic don spread for several neighbourhoods for Jos North.

Residents say di attack happun for Nasarawa Gwom community, wia tori be say a group of youths bin beat one man to death.

Di violence don triggered fear for nearby areas like Farin Gada, Terminus, Gada Bui and Filin Ball, as motorists and pipo for streets dey run to safety.

Videos for social media wey di BBC see show as pipo dey run kitikata and traffic came to standstill.

Journalists and residents wey follow BBC tori pesin tok say di video show as how tension don hold pipo for di area, although di authorities neva issue detailed statement about wetin happun.

Last Sunday, unknown gunmen attack Angwan Rukuba and Gari Ya Waye areas for Jos North, close to di University of Jos, for wetin be di deadliest attack for di area in years.

Police tok say di attackers arrive around 7:30 for evening wit motorcycles and open fire anyhow on top residents and pipo wey dey waka pass. Twelve pipo bin kpai instantly, according to wetin police tok.

Tori later come out say di death toll rose don rise to about 26, as rescuers start to. dey discover more bodies.

By Tuesday, tori pipo wey bin visit di area report say families bin still dey search for dia missing relatives, and more victims bin dey discovered.

Di Plateau State govment describe di attack as "barbaric and unprovoked", while President Bola Ahmed Tinubu condemn di killings and warn say di criminals responsible go dey brought to justice.

Govnor Caleb Muftwang also order 48‑hour curfew for di entire Jos North, starting from midnight on Sunday, to prevent di youths from carrying out reprisal attacks, but rada make security forces do dia investigation.

Howevea, on Wednesday, di authorities announce say dem go relax di curfew partially to allow di residents to move around during di day.

Despite easing di curfew, much of di city still remain quiet as markets remain closed, nobody for streets, and police and security officers full evriwia.

Nigeria Minister of Information, Mohammed Idris, on Tuesday tok say security forces don "contain di situation" and dem don launch operations to target and track down dose responsible.

Oga Idris say President Tinubu bin hold meeting wit di security chiefs and e also invite Plateau State Governor Caleb Mutfwang for further consultations.

No group don claim responsibility for di attack so far, and authorities neva confirm di identity or motive of di gunmen.

Plateau State dey for Nigeria's Middle Belt, a region wey don dey experience repeated cycles of violence.

Di capital Jos, wey be place wey dey popular for dia ethnic and religious diversity, don witness plenty outbreaks of violence over di past two decades.

As of dis Wednesday afternoon, security patrols still dey heavy across parts of Jos North, while residents continue to reduse dia movement sake of fears of further violence.