Tinubu order installation of cameras for Jos, oda tins president tok afta attack wey kill 26 pipo

Wia dis foto come from, X/@presidencynigeria
Nigeria President, Bola Tinubu don approve say make dem employ 1,000 forest guards for Plateau State.
Di state govnor, Caleb Mutfwang tok dis one follow di visit of di President to di state.
E tok say, "today visit na to console wit us and we dey truly grateful, Mr President say you come".
President Tinubu tok for di meeting wit stakeholders and victims of di attacks as e console wit di victims and call on state govment to do beta.
E tok to di victims say, "nothing dey wey fit do, no money weda na millions rather na to do our best to console una. I see di video wia you dey hold am, I see di pain wey dey go through you. I wan assure you say we go do our best make dis kain tin no happun again."
To di leadership, e hala say "We just want Jos make e be like di Jos wey we know from di last. Me and una govnor dem elect us on platform of safety. We bin don hear of stories like dis bifor, Why e be say we no dey learn lesson from di past".
E end im message say no be dis kain situation wey e wan enta Jos to mourn again.
Students of di University of Jos don dey removed go di Old Airport Roundabout for Jos, Plateau State. Dis dey come afta dem close di school sake of security kasala for di state capital.
Students dey seen as em start to dey carry dia bags go di aforementioned destination bifor dem go dey go house.
Tori be say Plateau State govment bin provide transport so di students go fit comot from school.
Di evacuation dey come afta Wednesday wen di university authorities bin direct student make dem comot hostels as kasala bin dey bubble for pa of Jos.
For statement wey di Deputy Registrar, Information and Public Relations, Emmanuel Madugu, di Vice-Chancellor, Tanko Ishaya, bin order di immediate evacuation of students na just in case of incasity.
Di evacuation dey come afta ginger follow kasala for Jos just hours afta di relaxation of one 48 hours curfew wey state govment bin lock down earlier afta di deadly Angwan Rukuba attack.
For Sunday night, March 29, gunmen open fire near one busy junction and kill at least 28 pipo wey include some university students and staff.
Afta di attack, tori comot say oda kasala bin burst for oda parts of di city and some of dem bin dey near di university.
Tori bin also dey of fresh casualties. Even though security don increase pipo still dey fear and residents dey ask make di intervention dey sustained.





