Tinubu ministers, appointees wey don resign to pursue political ambition

Read am in 5 mins

Some members of President Bola Tinubu cabinet don resign from dia office, according to di directive wey di president bin give make any appointee wey get political ambition ahead of 2027 election tender dia resignation on or bifor March 31.

Di three pipo wey don turn in dia resignation so far na di Minister of Power, Bayo Adelabu, Minister of Foreign Affairs Yusuf Tuggar and di Minister of State for Humanitarian Affairs Yusuf Sununu.

Oda appointees of di president for different sectors don also dey tender dia resignation as at Monday, 30 March, 2026.

So who and who don resign, and which oda ministers dey expected to put in dia resignation by di end of di day?

Yusuf Tuggar

Yusuf Tuggar for im resignation letter on Monday make am clear say di reason na bicos e wan contest for di govnorship election of Bauchi State.

Kimiebi Ebienfa, di tok-tok pesin for di Foreign Affairs Ministry, as well as Alkasim Abdulkadir, di tok-tok pesin for di Minister both confam di development to tori pipo.

"Di minister dey interested and e dey aspire to run for di govnorship seat of Bauchi State," Abdulkadir tok for im statement late on Monday.

Di Foreign Affairs Ministry say Tuggar bin make plenty achievements for im tenure as minister, including di evacuation of Nigerians wey dey face trouble for abroad, di development of ogbonge database for Nigerians wey dey for diaspora, plus diplomatic interventions to secure di release of Nigerians wey dem detain for foreign kontris.

Dem born oga Yusuf Tuggar for 1967 and e come from Gamawa Local Govment Area of Bauchi State. Im papa, Abubakar Tuggar bin represent Gamawa Federal Constituency for di House of Representatives for di Second Republic.

Tuggar get bachelor's degree for international relations from di United States International University, and e also get master's degree from Cambridge University.

Bifor im appointment as Foreign Affairs Minister, Tuggar bin don represent Gamawa for di House of Reps between 2007 and 2011, and e also work as Nigeria Ambassador to Germany from 2017 to 2023.

E don run two times for di govnorship seat of Bauch State but e no win am, now e wan try im luck di third time.

Yusuf Sununu

Oga Sununu come from Ngaski Local Govment Area of Kebbi State, and na medical doctor by training from di University of Maiduguri. E specialise for Obstetrics and Gynaecology.

Afta many years for medical practice, Sununu resign for 2019 as di Chief Consultant Special Grade 1 for di Federal Medical Centre, Birnin Kebbi, to join partisan politics.

E contest and win di House of Reps seat for Ngaski/Shanga/Yauri Federal Constituency of Kebbi State for 2019 and win am again for 2023 bifor Presido Tinubu appoint am as Minister.

For di House of Reps, Sununu bin also work as Chairman of di House Committee on Healthcare Services.

Tinubu bin first appoint am as Minister of State for Education bifor e later redeploy am to Humanitarian Services.

Oda appointees wey resign

Oda political nominees of di President don also dey tender dia resignation. Some of dem na:

Nasiru Gawuna: Chairman of di Governing Board of di Federal Mortgage Bank of Nigeria, wey bin don also run for govnorship for Kano State under di ruling All Progressives Congress (APC).

But tori be say Gawuna dey plan to comot from di APC and join di opposition joinbodi party, di African Democratic Congress (ADC), following di former Kano State Govnor Rabiu Musa Kwankwaso defection to ADC on Monday.

Anoda pesin na Abdulrazak Namdas from Adamawa State, wey Tinubu bin appoint as member of di governing board member of di Niger Delta Development Commission representing di North-East Zone.

Namdas tok say im resignation na sake of say e wan contest elective position for 2027.

Namdas don serve for di House of Reps for many years and even contest for di position of Speaker of di House for 2019, but e later step down dat time for Femi Gbajabiamila - di current Chief of Staff to President Tinubu.

Tori tok say e fit be say Namdas wan contest for di govnor of Adamawa State.

Minister of power Adelabu resign

Adebayo Adelabu: Di Minister of Power don resign.

Im resignation wey dey circulate online show say na 26 March im write to President Tinubu say im get plan to contest for Oyo governorship election.

Adelabu don make am known tey tey say e go run for Oyo State govnorship election, so im resignation dey expected.

A chartered accountant wey graduate wit first class for accountancy from Obafemi Awolowo University, Ile Ife, Osun State, Adelabu start im career for Pricewaterhouse Coopers (PwC) and e grow to later become deputy govnor of di Central Bank of Nigeria (CBN) for 2014.

Adelabu don run for di Oyo State govnorship seat two times - 2019 and 2023 - and e lose di two elections to di current govnor Seyi Makinde, but for October 2025, e tell tori pipo say "God don show am say dis 2027 na my turn".

Di power minister get plenty critics wey tok say im tenure for di ministry no bring any noticeable development for di electricity situation for Nigeria. In fact many tok say di situation dey worse sake of di plenty times wey di national grid don collapse, leaving almost di entire kontri for blackout.

Few days back, Adelabu bin apologise to Nigerians for di irregular power situation and tok say di circumstances dey beyond im control.