Wireless Festival cancel afta UK block Kanye West from entering di kontri - wetin im do?

Read am in 5 mins

Wireless Festival don dey cancelled afta UK block di headliner Kanye West from entering di kontri.

Di United Kingdom no gree for West to travel enta di kontri as pipo vex on top im planned set for di London festival dis summer.

For years, West don cause pipo to vex well-well wit im comment against Jewish pipo, racist and pro-Nazi tok-tok.

For statement, Wireless Festival tok say, "Di Home Office don withdrawn YE's ETA wey deny am entry to di United Kingdom. Bicos of dat, Wireless Festival don dey cancelled and we go give refunds for all ticket holders."

E continue say, "As evri Wireless Festival, multiple stakeholders bin dey consulted in advance bifor we book YE and no wahala comot dat time."

Dem add say, "Antisemitism for all forms dey hateful and we sabi di issues and personal impact dis kain mata get. As YE tok today, e sabi say words alone no go do and even wit dis e still dey hope say dem go give am chance to follow di Jewish community for UK tok."

Di Home Office tell di BBC say di rapper bin make di application to go UK on Monday through Electronic Travel Authorisation (ETA).

Dem say dia decision to refuse di request na sake of say for am to show face no go dey okay for public good.

Tok-tok pesin of di Campaign Against Antisemitism tok say di govment make di right decision even as dem call out di Wireless Festival and call dem "shameful" for dem to defend dia invitation till di end.

West bin tok say e "go dey grateful" to meet wit members of di Jewish community for di UK afta wahala start say dem give am headline booking for dis year Wireless Festival.

For statement wey e put outside, di rapper wey now call imsef Ye tok say e don "follow di tok-tok around Wireless and wan address am head on".

E add say "my goal na to come London and present show of change, bringing unity, peace and love through my music".

Ye bin offer say e go wan meet members of di community in pesin "to listen" as im add say "I know say words no go do - I gatz show change wit actions. If una dey open, I dey hear".

E don reach almost five years wey pipo dey vex for di rapper sake of im comments against Jewish pipo, but for long statement wey e write for di Wall Street Journal for January, e tok sorry and blame di whole mata on di manic episodes wey im bipolar disorder dey create even as e dey find way to come back mainstream.

Last week, West bin perform for two sold out concerts for Los Angeles SoFi Stadium, wia Travis Scott and Lauryn Hill bin make guest appearance.

Shadow Home Secretary Chris Philp tok say Oga West past antisemitic actions no be "one-off lapse, but na pattern of behaviour wey don cause real offence and distress to Jewish communities".

Education Secretary Bridget Phillipson say West past comments dey "completely unacceptable and absolutely disgusting".

"No place dey for dat kain hatred, bigotry or antisemitism from am or from anyone else," she tok.

However, she say she no fit comment on weda make di govment block im visa.

West bin dey expected to headline all three nights of Wireless, wey dey expected to attract 50,000 pipo per day, for Finsbury Park, north London, from 10-12 July.

On Sunday, di festival headline sponsor Pepsi bin pull out, while oda drinks giant Diageo bin also remove dia support "as e stand".

Australia cancel Oga West visa afta e release Heil Hitler last May.

Di Board of Deputies of British Jews bin accuse Wireless Festival, dia parent company Festival Republic and managing director Melvin Benn say dem dey "profit from racism".

On Sunday, di managing director of di festival defend di decision to use West do headliner of di festival say make pipo forgive am.

But Melvin Bennm, on Tuesday, for interview wit BBC Radio 4 Today programme admit say im company Festival Republic bin no consult wit Jewish communities for di UK bifor dem book am.

E say "potentially we for do dat one and e fit be mistake say we no do am".

Sir Starmer on Sunday tok say antisemitism "no good and dem gatz face am strongly anywia dem see am". E add say "evrione get responsibility to ensure say Britain na place wia Jewish pipo go feel safe".

Meanwhile, Stephen Silverman from di Campaign Against Antisemitism (CAA) don call di booking "astonishing".

"E dey good say sponsors now dey do di right tin and withdrawing dia support, but why dem go even reason to headline one artist wey less dan a year ago release music video for one song called Heil Hitler?" e tell BBC Radio 5Live.

'PR disaster'

West apology

West don make many pipo para sake of im string of antisemitic and pro-Nazi comments in recent years.

Dis include posting one foto wey be like symbol wey combine swastika and di Star of David and e say im go "death con 3 On Jewish pipo".

Dis January, di rapper apologise for one full-page advertisement for di Wall Street Journal, and e write say: "I no be Nazi or antisemite."

E say bipolar disorder mean say wen "you be manic, you no go tink say you dey sick" and e say im don "lose touch wit reality".

"I regret and I dey deeply sorry for my actions for dat state," e add.