Wetin be di Puerto Rico comment wey cause kasala for Donald Trump campaign?

Comedian Tony Hinchcliffe speak for Donald Trump rally for New York on Sunday, Oct. 27, 2024, wia e tok say Puerto Rico na "floating island of garbage"

Wia dis foto come from, Reuters

Read am in 5 mins

Donald Trump, di Republican Candidate for di US general election wey go happen on November 5, don come under pressure afta one comedian for one of im rally describe Puerto Rico as 'floating Island of garbage'.

Di comedian Tony Hinchcliffe tok dat one during Trump campaign rally for New York, afta one big Puerto Rican celebrity, Bad Bunny, endorse di Democratic candidate Kamala Harris for President.

Jennifer Lopez na anoda Puerto Rican celebrity wey bin don also endorse Harris.

Both Trump and im campaign don wash dia hand comot for di comment and tok say e no represent wetin dem think of Puerto Rico, but Kamala Harris and di Democratic party tok say di comment show di true identity of di Republican Party and dia candidate.

Hinchcliffe don tok say na joke e dey joke. "I love Puerto Rico and I dey go vacation for dia. I dey make fun of everyone," e tok. But some top Republican politicians don condemn di joke.

"Di joke no dey funny and e no be true. Puerto Ricans na amazing pipo and amazing Americans," US Senator Rick Scott tok.

Congresswoman Maria Elvira Salazar post for her X handle say she dey "disgusted" by di "racist comment" wey no "reflect di GOP values".

Di president of di Republican Party Puerto Rican branch say e no go vote for Donald Trump unless e personally issue apology.

Angel Cintron-Garcia, former member of Puerto Rico state legislature and di Republican party current chairman on di island, make di comment on di Jugando Pelota Dura talk show on Monday.

Wia be Puerto Rico and and dem fit vote for di US election?

Puerto Rican-Americans tell BBC say di 'Island-of-garbage' joke no dey funny to dem.
Wetin we call dis foto, Puerto Rican-Americans tell BBC say di 'Island-of-garbage' joke no dey funny to dem

Puerto Rico na one US island territory wey dey di Caribbean Islands.

Voters for Puerto Rico go dey able to take part in a symbolic ballot to signal di island preference for US president, but no be part of official election process.

Pipo for dia no fit vote for US presidential elections, but dem get big diaspora population wey dey live across di United States and dem get power to vote.

Puerto Ricans make up di second-largest Hispanic voting group for di US, according to di Pew Research Center, external.

Di joke no go down well wit Puerto Rico pipo for Pennsylvania wey be one of di seven key swing states wey dey usually decide who go win di US presidential election.

Across Pennsylvania, about 600,000 Latino pipo dey eligible to vote, and more dan 470,000 of dem na Puerto Ricans. Polls for dia show say Harris and Trump dey very tight race.

For di 2020 election, Democrats win for Pennsylvania wit small gap of 1.17 percent - about 82,000 votes.

One local resident wey say she no send both Trump and Harris, tell BBC say she surpise how di Trump team dey hurt dia own campaign.

"E dey crazy to me," Ivonne Torres Miranda tok. "Even if he bin dey joke - you no suppose dey joke like dat.

"We be Puerto Ricans. We get dignity, and we get pride. You suppose reason some things bifor you tok am."

One Harris supporter, Jessie Ramos, tok say di joke don make dia job of winning di state easier.

"E just put am in di bag for us. E literally just give us di win. E no get any idea how hard di Latino community go come out and support Kamala Harris."

But weda or not dis joke go cause Puerto Rican voters to change dia minds, nobody dey sure.

Dalma Santiago, owner of one Puerto Rican restaurant wia Harris bin visit during her campaign on Sunday, tell BBC say im no sure weda di joke go make any difference, but im know say pipo hear am "loud and clear".

"Everybody get dia own opinion, but nobody go forget dat one," e tok.

Even among some strong Trump supporters, dem feel say di joke dey in bad taste.

One of dem na Jessenia Anderson wey be military veteran, she dey attend Trump rallies for Pennsylvania well-well.

She describe di joke as "deeply offensive" and ask her fellow Republicans to always dey engage in "thoughtful and respectful conversations".

But she no get any plan to switch her vote.

"My belief for di party potential to make a positive impact still dey strong. I sha hope say dem go dey approach Latino voters wit di respect wey dem deserve," she tok.