Wetin we know about Plateau deadly attack as govment impose 48 hours curfew

Wia dis foto come from, Caleb Mutfwang, Alex Babir/Facebook

Read am in 6 mins

Di Plateau State Govment don impose 48 hours curfew on Jos North Local Govment Area afta one deadly attack on Sunday kpai several residents and injure many odas for di Gari Ya Waye community of Anguwan Rukuba.

Di Commissioner for Information and Communication, Rt Hon Joyce Lohya Ramnap, say di govment condemn di "barbaric and unprovoked attack on innocent citizens".

She say di curfew take effect from midnight on Sunday and go remain in force until April 1, 2026.

According to govment officials, di measure dey necessary to prevent further breakdown of law and order while security agencies dey work to track down di perpetrators.

Tori be say unidentified gunmen wey bin dey ontop okada shoot and kpai unspecified number of youths for Anguwan Rukuba.

Afta di attack, angry youths bin reportedly block major roads within di community, and dis bin raise fears of escalating tension.

Local reports say at least 12 pipo kpai, while many odas get gunshot wounds and dem carry dem go nearby medical facilities for treatment.

Dem neva know di exact number of casualties as authorities neva officially confam di number.

For statement, di Plateau state govnor, Caleb Mutfwang, condemn di killings and describe am as "barbaric and unprovoked," and say e don direct security agencies to pursue di pipo wey dey responsible and bring dem to justice.

Sake of di curfew, govment don order residents to stay inside house as security personnel dey intensify patrols and maintain visible presence across di affected areas.

Afta di shooting, dem deploy security pipo sharp-sharp, dem also send troops and oda personnel to go secure di area and restore calm.

Authorities say operations dey go on, including efforts to track down di attackers.

Di incident don also scata di normal life for Jos. Some institutions, including di University of Jos, don adjust dia schedules sake of safety concerns - and dis dey reflect di wider impact of di kasala for di community.

Plateau State dey for Nigeria Middle Belt, and dem dey see am since as one of di most volatile regions for di kontri wia violence and attacks dey happun from time to time.

Jos, di state capital, dey witness repeated episodes of unrest ova di past twenty years.

Even though govment and security dey try to maintain stability, sometimes e be like say e neva really work.

Di state govment urge residents to remain vigilant and cooperate wit authorities by providing information wey fit help ongoing investigations.

Timeline of attacks and killings for central Nigeria

March 2025 - For ending of March, about 52 pipo bin kpai for inside one attack for Bokkos local govment area of Plateau State.

Di development bin make di National Security Adviser (NSA) Nuhu Ribadu to visit di area and tok say enough don dey enough for di killers, and e go make sure say di killings stop.

Wit all di ginger wey dat tori bin make, di killings still dey go on.

April 2025 - Anoda attack bin happun for Bassa local govment area of Plateau State, north-central Nigeria, according to wetin residents bin tell BBC News Pidgin.

Di attack bin happun for di early hours of Monday, 14 April between 1:00am and 2:00am.

Yakubu Ventim wey be tori pesin for di state bin tok say di chairman of Bassa local govment area, Joshua Sunday Riti, bin carry some TV tori pipo wit plenty security to di community wia di attack bin happun.

"Na about 38 to 50 pipo dem bin massacre for di village dis morning. Dem ambush di community and kill mostly women and children," oga Ventim tok.

May 2025 - At least 10 pipo die sake of kasala between herders and farmers for Riyom Local Govment Area of Plateau State.

Tori pipo Channels Television bin report say from wetin start from farm destruction, cattle rustling, and attacks on livestock, pipo from both Fulani and Berom communities clash.

Dem add say statement from Operation Safe Haven confam say di insecurity for di council area bin start on Monday, May 12, 2025, wen suspected youths bin slaughter and rustle cattle wey bin enta dia farms for Dayan village, Riyom Local Govment Area.

To take revenge, di herders attack Danchindo village on di evening of May 13, dem kill four pipo bifor dem run as dem hear say police dey come.

On May 14, di villagers bin kill 26 cows as dem dey para say dem kill dia pipo.

Di herders later come back again dat day, dem attack one settlement near Wereng Kam community, wia dem kill six locals.

June 2025 - E be like say di month of June record di highest killings in recent times for Benue State.

Di number of pipo wey die from di attacks on Gwer West and Apa Local Govment areas of Benue State pass 50.

Eyewitnesses bin also tok say some pipo still dey miss sake of out of fear and to run for dia lives some pipo jump inside well.

Suspected herdsmen bin attack residents of Tse-Antswam for Naka town, wey be headquarters of Gwer West LGA and Edikwu Ankpali for Apa Local Govment area of Benue State.

According to Nema first report on Monday 16 June, 2025, na 100 pipo die, and 6,500 dey displaced for di Benue attack.

But locals and oda tori pipo tok say di number dey around 200.

Ova di years, kasala between herders and farmers na regular tin for many parts of northern Nigeria including Plateau and Benue states.

July 2025 - one fresh attack wey suspected gunmen carry out kill 27 pipo, for one attack wey happun for Bindi (Jebu) village, Tahoss community, Riyom Local Govment Area of Plateau State north central Nigeria.

National Chairman of Berom Youth Moulders-Association, Solomon Dalyop Mwantiri, yarn give BBC News Pidgin say di incident wey happun don bring back serious concern about how safe rural communities dey for di state.

E add say di attack wey kill 27 pipo including women and children happun on Tuesday.

"Around 3:am, hundreds of dem enta di whole area. Di vigilante pipo try resist dem, and military position demselfs for two different places.

November 2025 - One attack happun for di Christ Apostolic Church (CAC) for Oke Isegun, for Ekiti Local Govment Are, Kwara State, during di church evening programme.

Di 38 worshippers wey jaguda pipo kidnap from di church for Eruku community, on Tuesday,18 November, later regain dia freedom.

Dem later regain dia freedom.

January 2026- Earlier dis year bandits attack pipo for Kasuwan Daji market, dem catch up to almost 40 pipo, tie dia hand for dia back, den slaughter dem wit knife.

For statement, tok-tok pesin for di Niger State Police Command, Wasiu Abiodun say na around 4:30 on Saturday night di bandits attack di village.

"Suspected bandits for National Park Forest along Kabe District, invade Kasuwan-Daji wey dey for Demo Village via Kabe. Dem burn di market, loot shops and carry items.

February 2026 - Gunmen for February bin attack Woro community for Kwara state and kpai pipo.

Witnesses of Woro community tell BBC say about 100 gunmen attack di community on Tuesday evening.