King Charles III: A life in pictures

Wia dis foto come from, Getty Images

Charles III, di longest-serving heir to di throne in British history, be now King. Im apprenticeship as heir, lasting 70 years, don make am di oldest new monarch ever to ascend to di throne.

Take a look back at some of di key moments wey don shape di life of 73-year-old King Charles III.

Wia dis foto come from, Mirrorpix / Getty Images

Wetin we call dis foto, Charles Philip Arthur George dem born am on 14 November 1948, and be just over three years old wen im mama dey crowned Queen

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, He be only one year old wen im experience di first of wetin go be a series of separations from im parents, wen im mama fly to Malta to join Prince Philip wey bin still be a serving naval officer

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, Di young Charles bin dey often in di care of nursery staff during dis times of separation

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Im dey educated for house until di age of eight, Charles became di first heir apparent to attend a school - hia dem snap for camera playing football in 1957

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, He bin enjoy a very close relationship wit im grandmother, di Queen Mother

Wia dis foto come from, Keystone / Getty Images

Wetin we call dis foto, In a move to make tough, Charles dey sent to complete im school years inside Gordonstoun, Scotland, but he dem bully am and e beg im parents to allow him to leave

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, Charles read first Archaeology and Anthropology and den History for Trinity College, Cambridge - he be di first heir to di throne to complete a degree course

Wia dis foto come from, Central Press / Getty Images

Wetin we call dis foto, In July 1969, Charles dey invested as Prince of Wales for one ceremony dem hold for Caernarfon Castle, giving im speech in both Welsh and English

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, He follow di family tradition of military service, qualifying as a pilot at RAF Cranwell before e move to di Royal Naval College at Dartmouth

Wia dis foto come from, Central Press / Getty Images

Wetin we call dis foto, He go through rigorous military training and earn di title of "Action Man" as, inside one series of military drills, he throw himself out of planes, escape from submarines and train as a diver and commando

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, Afta service on various vessels, Charles take command of di mine hunter HMS Bronington for im final term in di Royal Navy

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, As he near im 30th birthday, di then Prince of Wales become known as sometin of a playboy

Wia dis foto come from, Hulton Archive / Getty Images

Wetin we call dis foto, One of di world's most eligible bachelors, he dey photographed playing polo, swimming and windsurfing

Wia dis foto come from, Hulton Royals Collection / Getty Images

Wetin we call dis foto, He bin also romantically dey linked to a number of women, including Camilla Parker Bowles

Wia dis foto come from, Hulton Archive / Getty Images

Wetin we call dis foto, Although much discussion bin dey at di time about finding di Prince a "real job", he undertake a number of royal tours and bin dey involved in charity work, forming im Prince Trust in 1976

Wia dis foto come from, Hulton Archive / Getty Images

Wetin we call dis foto, In 1981, after intense press speculation, e dey announced say Charles dey engaged to Lady Diana Spencer

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, Five months later dem married in St Paul's Cathedral - an estimated 600,000 pio bin fill di streets of London to catch a glimpse of di couple on dia wedding day

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di couple pose for a photo on di banks of di River Dee in di grounds of Balmoral Castle, inside Scotland, during di final leg of dia honeymoon

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Despite di arrival of two children, Prince William in 1982 and im younger brother Prince Harry in 1984, di marriage bin dey in trouble and Charles and Diana formally divorce in July 1996, citing "irreconcilable differences"

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Following di sudden death of Diana for car crash inside Paris in 1997, Charles insist say she go get a royal funeral

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Diana death forced di monarchy to rethink dia image and Charles adopt to change quickly, coming out as a caring and supportive father and as a modern heir

Wia dis foto come from, PA

Wetin we call dis foto, Accused of being remote and insensitive afta Diana death, Charles bin attempt to project a new image and connect wit pipo

Wia dis foto come from, Tim Graham Photo Library via Getty Images

Wetin we call dis foto, He don bin dey outspoken on a number of issues, expressing support for organic farming and alternative medicine, and opposition to genetically modified crops

Wia dis foto come from, Shutterstock

Wetin we call dis foto, Critical of modern architecture, im vision for town planning achieve tangible form in Poundbury village, for Dorset

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, In 2002, he speak in a moving way of im "magical" grandmother - di Queen Mother - wey die peacefully in her sleep at di age of 101. He stand in vigil as her coffin lye in state at Westminster Hall in London.

Wia dis foto come from, Wireimage / Getty Images

Wetin we call dis foto, Over di years Charles maintain im relationship wit Camilla Parker Bowles, and di couple announce dia engagement in 2005, as dem first meet in 1970

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, He become di first member of di Royal Family to wed inside a civil ceremony - Mrs Parker Bowles become di Duchess of Cornwall, and upon Charles succession to di throne she don become Queen consort

Wia dis foto come from, PA

Wetin we call dis foto, In 2011, im elder son, Prince William, marry Kate Middleton inside Westminster Abbey

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, The King first grandchildren Prince George and Princess Charlotte dey born in 2013 and 2015

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, King Charles III waka Meghan Markle down di aisle wen she mary Prince Harry in 2018

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, Di King bin dey visibly upset as im lead di procession behind im father Prince Philip coffin during di funeral for Windsor Castle in 2021

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Charles don become King at a time wen public attitudes towards royalty dey change

All images dey subject to copyright.