John Legend na Peoples Magazine 'sexiest man alive' for 2019
Wia dis foto come from, Getty Images
John Legend na di 'sexiest man alive' for 2019, based on People magazine ranking.
Di 40-year-old singer don follow in di footsteps of former winners Dwayne 'The Rock' Johnson, David Beckham and , Idris Elba.
Di ogbonge American singer say di honour go bring unwanted attention, especially as im collect di title from Idris.
Im tell People magazine say: "Everybody eye go dey my body now to check weda true-true I dey sexy enough to hold dis title.
Dis na di latest accolade for oga Legend, wey last year join di exclusive EGOT club, as im become one of few pipo to win Emmy, Grammy, Oscar and Tony award.
Top Tori
Informate me
Di one wey dem dey read well well
Content is not available
{{rankTranslation}}