Oscars 2018: See as stars slay for red carpet

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Black Panther and Walking Dead actress Danai Gurira dey show di back of her head wey she decorate

Di 90th annual Academy Awards - wey people sabi as Oscars - dey always bring opportunity for fashion. Nobody wan carry last for red carpet. See di correct styles wey film stars and celebrities wear come di event.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Get Out star and British actor Daniel Kaluuya chop Oscar nomination

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Lupita Nyong'o win Oscar for 2012 for her film 12 Years a Slave

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Dis metallic dress wey Hunger Games star Jennifer Lawrence wear resemble silver Oscar statue

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, American singer and songwriter Andra Day balance for red carpet floor say make people come see her flower gown

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Spider Man Tom Holland nack correct suit to present award for di ceremony

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Wakanda king T'Challa (Black Panther) Chadwick Boseman show for Oscars with im Givenchy suit

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Ashley Judd wey put mouth for di Time's Up movement nack dis purple dress for red carpet

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Na so plenty people open mouth when Olympic figure skater Adam Rippon show with im tuxedo and black leather belts like say im just comot from insde Fifty Shades Of Grey

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Salma Hayek wear purple gown

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Click...click...click! Na so foto people dey snap dey go as Three Billboards Darrell Britt-Gibson jump for red carpet

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Another flower gown. Whoopi Goldberg use her flower dress do to-match with her dragon tattoo

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, X-Men star Sir Patrick Stewart bin wear Time's Up pin as e blow kiss troway camera people dem

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, British actress Sally Hawkins, wey get nomination for best actress for Di Shape of Water, smile give camera

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Lady Bird star and nominee Saoirse Ronan wear pink gown, 10 years after she first appear for Oscars for 2008 when she bin 13-years-old

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Ogbonge film star Meryl Streep don chop 21 Oscar nominations for her career.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Star of I, Tonya film, Margot Robbie dey look coole for red carpet

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Tiffany Haddish nack correct traditional African dress wey women for Eritrea and Ethiopia dey wear

All di fotos dem get copyright.