Explosion don happen for London train station
Wia dis foto come from, Twitter/@rrigs
Police for London dey investigate after report of explosion for one District Line Underground train for south-west London.
One picture for social media show white bucket inside supermarket bag, but e no show how much damage di thing don do.
People wey see as e happen say some passengers get wound for face.
Dis explosion happen for di Parsons Green station for di Fulham area of di capital.
We go bring you more tori on dis matter.
Wia dis foto come from, Alex Littlefield
Wia dis foto come from, Emma Stevie
Wia dis foto come from, Alex Littlefield
Top Tori
Informate me
Di one wey dem dey read well well
Content is not available
{{rankTranslation}}